Nigerian Pidgin Bible
Matthew 8
1 Afta Jisos kom dan from di mountin, plenti pipol kon folo am.
2 Won lepa kon mit am, nil dan for en front, kon sey, 'Oga, if yu wont, yu go fit heal mi, so dat my bodi go wel?
3 Jisos tosh di man kon sey, "Yes, I wont mak yu wel! At wons, di siknes komot from di man bodi.
4 Den, Jisos tel am, "Nor tel enibodi, bot go mit di prist, mak e luk yu. Afta, go giv di offrin wey Mosis komand.
5 Wen Jisos enta Kapanum, won Roman ofisa kon mit am dey beg mak e help am.
6 Di ofisa sey, "Oga, my savant dey wey nor wel for haus, e nor fit get up and en bodi dey pain am wel-wel.
7 Jisos kon ansa, "I go kom heal am.
8 Bot di ofisa sey, "Oga, I nor big rish hu yu go enta en haus, insted jos tok and my savant go wel.
9 Mi-sef, I bi man wey get oga and I stil get sojas wey dey unda mi. If I komand won sey mak e 'Go', e go-go, if I komand anoda won sey mak e 'Kom', e go kom and if I komand my savant mak e 'Du dis tin', e go du-am.
10 Wen Jisos hear wetin e tok, e sopraiz, den e tel di pipol wey dey folo am, "I tel una tru wod, I neva si enibodi wey get dis kaind fate for Izrel!
11 Meni pipol from east and west go kom folo Abraham, Izik and Jakop chop insaid God Kindom.
12 Bot, dem go trow di pipol wey sopoz enta di Kindom for daknes, wer dem go dey krai and grind dia tit.
13 Den Jisos kon tel di ofisa, "Go, since yu biliv, na so e go bi for yu. Na dat same taim di savant wel.
14 Wen Jisos enta Pita haus, e kon si sey Pita wife mama nor wel.
15 Den e tosh di wuman and di fiva komot from en bodi. So, di wuman get up kon bigin serv dem.
16 Wen evenin rish, dem bring meni pipol wey dimon dey insaid dem kom mit Jisos. E driv di wiked spirits komot kon heal all di pipol wey nor wel.
17 Dis won mak wetin Profet Isaia tok bi tru, "E rimov awa siknes and kari awa diziz komot
18 Wen Jisos si plenti pipol gada am, e kon komand en disaipols mak dem kros go di oda side for di riva.
19 Won law tisha kon tel Jisos, "Tisha, I go folo yu go eniwer wey yu dey go.
20 Jisos kon ansa am, "Rabbit and bird get dia own haus, bot Man Pikin nor get wer e go fit res en head.
21 Anoda disaipol kon sey, "Oga, mak I first go bere my papa.
22 Jisos ansa am, "Folo mi, mak doz wey don die bere dia dead bodi.
23 As Jisos enta di boat, en disaipols kon folo am.
24 At wons, strong briz kon dey blow for di sea and wave won sink di boat. Bot Jisos Kraist dey slip.
25 So en disaipols wak-am kon sey, "Oga, save us! Na die wi dey die so o-o!
26 Jisos ansa dem, "Una fate smol o-o. Wetin mak una dey fear? Den e get up, komand di briz and di wave sey mak dem stop and evriwer kon kwayet at wons.
27 Di men sopraiz wel-wel kon dey ask ish oda, "Wish kaind man bi dis? Ivun briz and wave dey obey am!
28 Wen Jisos rish di oda side wer Gadarene pipol dey stay, tu men wey get dimon, run from di beria groun kom mit am. Nobodi dey fit pas dat road bikos di men wiked wel-wel.
29 Di dimons kon hala, "God Pikin, yu nor go liv us, abi yu kom sofa us wen taim neva rish?
30 For wer dem dey, plenti pig dey chop near der.
31 Den di dimons kon beg Jisos, "If yu driv us komot, mak yu send us go enta insaid di pigs.
32 So Jisos tel dem, "Mak una go! At wons, dem kon komot enta insaid di pigs and all di pigs rush go enta di riva, kon die.
33 Di pipol wey dey luk di pigs, run go di tawn kon tel pipol evritin wey hapun to di men wey get dimons.
34 Den evribodi for di tawn kon dey faind Jisos. Wen dem si-am, dem kon beg am mak e komot from dia aria.