Nigerian Pidgin Bible
Matthew 27
1 For earli mornin, di prist oga dem and di eldas kon dey plan as dem go tak kil Jisos.
2 Dem tie am kon tak am go mit Pilate, wey bi di govnor.
3 Wen Judas wey sel Jisos si sey dem kondemn am, en maind kon dey joj am for wetin e du, so e riton di tati silva koins giv di prist oga dem and eldas,
4 e kon sey, "I don sin as I sel dis inosent man mak dem kil-am! Bot dem sey, "Haw dat won tak konsan us? Na yor biznes bi dat.
5 So Judas kon trow di silva koins insaid di Tempol, den e komot go hang ensef.
6 Di prist oga dem tak di moni kon sey, "Mosis law sey mak dem nor put blood moni for di Tempol purse.
7 Afta dem don tok di mata, dem kon tak di moni buy won land wey di name bi "'Potta and na strangas dem dey bere for der.
8 Na bikos of dis mak dem dey kol di land "Blood Field kon rish today.
9 So wetin profet Jeremia tok kon hapun: "Dem tak tati silva koins, di moni wey Izrel pipol don agri to tak sel Jisos,
10 den dem yuz di moni tak buy 'Di Potta land', jos as God tel mi.
11 As Jisos stand for di govnor front, di govnor kon ask am, "Na yu bi di Ju pipol king? Jisos ansa, "Na as yu tok!
12 Wen di prist oga dem and di eldas dey akiuz Jisos, e nor ansa dem.
13 Den Pilate kon tel Jisos, "Yu nor hear all di tins wey dem dey tok sey yu du?
14 Bot Jisos nor ansa and di govnor kon sopraiz wel-wel.
15 For Passova Fist, di govnor dey always riliz won prizina giv di pipol.
16 Dat taim, e get won wiked prizina wey en name na (Jisos) Barabbas.
17 So, wen dem don gada, Pilate ask dem, "Hu una wont mak I riliz giv una? (Jisos) Barabbas or Jisos Kraist?
18( Bikos Pilate no sey na jelosi mak dem bring Jisos Kraist kom mit am.)
19 As Pilate sidan for di jojment sit, en wife send mesage go mit am sey, "Nor put hand for dat inosent man mata, bikos last nite, I dream bad dream abaut am.
20 Bot di prist oga dem and di eldas sey mak di pipol ask for Barabbas, so dat dem go fit kil Jisos Kraist.
21 Di govnor kon ask dem, "Wish won for dis tu pipol una wont mak I riliz giv una? Dem ansa, "Barabbas!
22 So, Pilate ask dem again, "Den wetin I go du wit Jisos wey dem dey kol Kraist? All of dem kon ansa, "Nail am for kros!
23 Pilate kon ask, "Why? Wish bad tin e du? Bot dem kon dey shaut more-more, "Nail am for kros!
24 Wen Pilate si sey di pipol nor gri and trobol won start, e kon tak wota, wosh en hand for di pipol front dey sey, "Dis man blood nor dey my head. Mak onli una go kil-am!
25 Di pipol kon ansa, "Mak en blood dey awa head and awa shildren own!
26 Den Pilate riliz Barabbas giv dem. Afta dem flog Jisos Kraist, Pilate kon giv-am to dem mak dem nail am for kros.
27 Di sojas tak Jisos Kraist enta di govnor haus and all of dem kon gada am.
28 Dem rimov en klot, kon wear am klot wey mak-am bi laik king.
29 Dem kon tak shuku-shuku mak krawn wear-am for en head, kon put wokin stick for en hand, den nil dan for en front kon dey laff am dey sey: "Mak una hail Ju pipol king -o-o!
30 Dem spit for en bodi, kon tak wokin stick nak en head meni taims.
31 Wen dem laff am finish, dem rimov di king klot wey dem wear am kon wear am en own klot. Den dem kon tak am go nail for kros.
32 As dem dey go outsaid, dem si won man from Syrene wey en name na Saimon and dem kon fos am mak e kari Jisos Kraist kros.
33 Wen dem rish won place wey dem dey kol Golgota (wey min "Skul Place"),
34 dem kon giv Jisos Kraist bita wine mak e drink. Bot wen e taste am, e nor gri drink am.
35 Wen dem don nail am for kros, dem kon gambol tak davaid en klot.
36 Dem kon sidan der dey luk mak enibodi nor tosh am.
37 On-top of en head for di kros, dem rite wetin dem tak akiuz am: "Dis na Jisos Kraist, Ju pipol king.
38 Dem stil nail tu tif near Jisos Kraist for kros, won for en rite and di oda for in left hand.
39 So di pipol wey dey pas wer Jisos Kraist dey kon laff am and dey shake dia head
40 dey sey, "Yu wey sey yu go distroi di Tempol kon build am bak for tiri days, mak yu save yorsef! If yu rili bi God Pikin, mak yu kom dan from di kros!
41 Na laik dis tu, di prist oga dem, di law tishas and di eldas dey laff am sey,
42 E save oda pipol bot e nor fit save ensef! If e kom dan naw from di kros, wi go biliv sey, Na-im bi Izrel King!!
43 Since e trust God, mak God kon save am naw, bikos e sey, "I bi God Pikin!
44 Di tu tif wey dem nail for kros near Jisos Kraist stil dey kos am tu.
45 E kon hapun sey, from twef go rish tiri o' klok for aftanun, daknes kon kovadi hol land.
46 Wen tiri o' klok won rish, Jisos Kraist kon shaut, "Eli, Eli, lama Sabachthani?", wey min, "My God, My God, wetin mak Yu abandon mi?
47 Some of di pipol wey hear di wod kon sey, "Dis Man dey kol Elija mak e kom help am.
48 At wons, won of dem run go bring sponge kon soak am for wine wey don sawa, put am for stick, den kon giv Jisos mak e drink.
49 Bot di rimainin pipol sey, "Leav am! Mak wi si weda Elija go kom save am".
50 So Jisos Kraist krai again, den e kon die.
51 At wons, di Tempol kotin kon tear from up go rish botom. Di groun bigin shake and rocks kon skata for evriwer.
52 Graves kon opun God pipol wey don die kom wak-up.
53 Afta Jisos raiz from grave, God pipol wey don die folo am raiz, den dem kon enta di Holi Tawn wit am and meni pipol si dem
54 Wen di soja oga and di pipol wey dey gaid Jisos Kraist si di eart-quake and wetin hapun, dem fear wel-wel kon sey, "Tru-tru dis man na God Pikin.
55 Meni wimen wey folo Jisos Kraist from Galili and wey dey help am, dey der tu. Dem dey luk wetin dey hapun for der.
56 Mary Magdalene, Mary, wey bi James and Josef mama and Zebedi shildren mama, dey der tu.
57 Wen evenin rish, Josef, won rish man from Arimatia, wey bi Jisos Kraist disaipol
58 go mit Pilate, kon ask am for Jisos Kraist bodi. So Pilate kon sey mak dem gi-am di bodi.
59 Josef kon tak di bodi, wrap am wit klin white klot.
60 E put am insaid en own new grave wey e dig insaid rock. Den e rol won big stone kova di grave mout.
61( Mary Magdalene and di oda Mary sidan for di oda side wey face di grave).
62 Di next day (wey bi Sabat) di prist oga dem and di Farisi pipol kon gada for Pilate front
63 kon sey "Oga! wi rimemba sey wen dat wayo man stil dey for dis wold, e tok sey, 'Afta tiri days, e go wak-up.'
64 So mak yu giv orda mak dem gaid di grave ontil di tiri day rish. If not, en disaipols go-go tif en bodi kon tel pipol sey, 'E don wak-up from deat' and dis go mak di last wayo wors pas di first won.
65 So Pilate tel dem, "Mak una tak plenti sojas go gaid di place as una wont.
66 So dem kari sojas go gaid di grave and dem kon blok di grave mout, so dat Jisos Kraist nor go fit kom out.