Nigerian Pidgin Bible
Matthew 23
1 Jisos kon tel di pipol and en disaipols sey,
2 Na di law tishas and Farisi pipol dey tok wetin Mosis law min.
3 So mak una listin to wetin dem dey tel una and du-am. Bot nor du wetin dem dey du, bikos dem nor dey du wetin dem dey tish.
4 Dem dey put heavi load for pipol shoulda and dem nor redi to help dem.
5 All wetin dem dey du, na mak pipol for si dem. Dem dey tie tins wey dem rite God wod put for dia forehead and hand, mak pipol for si dem.
6 Dem laik beta place for parti and beta chair for insaid sinagog.
7 Dem laik mak pipol dey grit dem wit respet for market and mak pipol dey kol dem, 'Tisha.'
8 Nor let enibodi kol yu 'Tisha,' bikos na onli won tisha una get and all of una na brodas.
9 Mak una nor kol enibodi for dis wold "Papa", bikos na onli won ril Papa una get and e dey for hevun.
10 Mak yu nor let pipol kol yu 'Leada,' bikos na onli won lida una get and na-im bi Kraist.
11 Di pesin wey big pas among una, go bi una savant.
12 Enibodi wey dey kari bodi up, God go bring am dan and enibodi wey nor dey kari bodi up, God go raiz-am up.
13 Bot e go bad for una wey dey tish di law and una Farisi pipol, una wey dey pritend! Una klose door mak pipol nor for fit enta God Kindom! Unasef nor go enta and una nor won mak odas enta.
14 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisi pipol, una wey dey pritend! Una dey yuz long praya shit wimen wey dia husban don die, bikos of dis, God go ponish una wel-wel.
15 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisi pipol, una wey dey pritend! Una dey travol go evriwer jos to win won pesin kon mit God and afta una don win am, una go kon mak am bad wel-wel laik devol pikin, jos as una bi!
16 E go bad for una, lidas wey blind, una sey, 'Enibodi wey tak di Tempol swear, nortin go du-am. Bot if e tak di gold for Tempol swear, kos go dey for en head.'
17 Una bi fools wey blind! Wish won big pas, na di gold or di Tempol wey mak di gold holi?
18 Una dey tish sey, 'Enibodi wey tak di altar swear, nortin go du-am, bot if pesin tak wetin dey for di altar swear, e must du wetin e tok.'
19 Una blind o-o! Wish won big pas, na di gift or di altar wey mak di gift holi?
20 So, enibodi wey tak di altar swear, na both di altar and evritin wey dey insaid, e tak swear.
21 And enibodi tak wey di Tempol swear, na both di Tempol and God wey dey stay insaid, e tak swear.
22 Enibodi wey tak hevun swear, na both God throne and di Pesin wey sidan put, e tak swear.
23 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisi pipol, una wey dey pritend! Una dey giv won out of evri ten tins wey una get, bot una nor dey du di important tin wey di law tok, wey bi to giv koret jojment, to trit pipol wel and to du wetin dey gud! Una sopoz to dey du dis tins join di oda wons.
24 Una wey bi oga wey blind! Una dey rimov flai from una drink, bot una dey swalow melu!
25 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisi pipol, una wey dey pritend! Una dey wosh cup and plate bodi mak dem for klin, bot bad bele and long trot ful insaid una.
26 Una Farisi pipol wey blind! Mak una first wosh insaid di cup, den di outsaid go klin tu!
27 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisi pipol, una wey dey pritend! Una bi laik grave wey fine for outsaid, bot di pesin bodi for insaid, don rotin.
28 Na so e bi wit una tu, for outsaid, una bi laik gud pipol, bot for insaid, na wayo and sin ful una life.
29 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisi pipol, una wey dey pritend! Una build grave for di profet wey don die kon dekorate coffin for pipol wey fear God.
30 And una sey, 'If to sey wi dey alaif for awa gran-gran papa dem taim, wi nor for help dem wen dem dey kil di profets.'
31 So na una gran-gran papa dem kil di profets.
32 Mak una go finish di wok wey una gran-gran papa start!
33 Una bi snake! Wiked snake shildren! Haw una go tak eskape hell?
34 I go send profets, wise pipol and law tishas kom mit una and una go kil and nail som for kros, flog som insaid una sinagog, den porshu di odas from won tawn go anoda.
35 So all God pipol blood wey una kil for dis wold, go dey una head. From Abel blood go rish Zecharia wey bi Barachia pikin, wey una kil for insaid di Tempol.
36 I tel una tru wod, pipol for dis generashon go sofa di ponishment for dis tins wey una du!
37 O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kil di profets and stone di pipol wey God send kom mit una! I don dey trai to gada una shildren as fawo dey gada en shildren unda am, bot una nor let mi du-am.
38 Si, from today go, una go skata and una haus go empti.
39 Mak una no sey, una nor go si mi again ontil una go sey, 'Mak God bless di pesin wey kom wit God name!'"