Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 22

1 Jisos kon tok to dem again for parabol sey:

2 “God Kindom bi laik wen won king du marage for en son.

3 “E send en savant go kol di pipol wey dem invite kom di parti, bot dem nor gri kom.

4 “Den e send oda savants sey, 'mak una go tel di pipol wey wi invite sey, "Si! Di parti go soon start. I don kil big melu and oda animas and evritin don redi, so mak una kom for di marage."'

5 “Bot di pipol nor gri listin to wetin di savants tok, insted won go en farm and di oda kon go du en biznes.

6 “Di oda wons seize di savants, beat dem enihaw and kil som of dem.

7 “Di king ves wel-wel kon send en sojas mak dem go kil di pipol wey kil en savants and mak dem burn evritin for di tawn.

8 “Den e kon tel en savants. 'Di marage don start,' di pipol wey I invite bifor, nor bi di pipol wey sopoz kom.

9 “So mak una go di streets and invite evribodi wey una si kom di parti.

10 “So di savants go di streets kon gada all di pipol wey dem si, both bad and gud, kom di marage and di hal kon ful.

11 “Wen di king si di pipol wey kom di parti, e kon si won man wey nor wear marage klot.

12 “So di king kon ask am, 'My frend, haw yu tak enta here wen yu nor wear marage klot?' Bot di man nor fit ansa am.

13 “Den di king kon tel en savants, 'Mak una tie en hand and leg trow am outsaid for daknes, wer e go krai and grind en tit.'

14 “Na onli few pipol God shuz from di meni wey e kol. “

15 Den di Farisi pipol komot go plan haw dem go tak kash Jisos wit wetin e go tok.

16 So dem kon send dia disaipols, wit som pipol wey dey sopot Herod, go mit Jisos sey, "Tisha, wi no sey yu dey tok trut wel-wel and yu dey tish wetin God wont. Yu nor dey favor enibodi, bikos yu nor dey play wayo.

17 “Wetin yu tink? E gud mak wi pay tax giv Caesar? “

18 Bot Jisos no dia wiked plan, so e kon tel dem, "Una wey dey pritend! Why una won set trap for mi?

19 “Mak una show mi di moni wey una dey tak pay tax. “So dem kon bring di moni kom.

20 Jisos kon ask dem, "Wish pesin face and name dem stamp put for di moni? “

21 Dem ansa, "Na Caesar own. “Jisos kon tel dem, "Den, mak una giv Caesar wetin bi Caesar own and giv God, wetin bi God own. “

22 So wen dem hear wetin e tok, dem kon waka liv am.

23 For di same day, di Sadusi pipol (wey biliv sey resureshon nor dey) kom mit and ask Jisos,

24 “Tisha, Mosis tok sey, 'If man wey nor get pikin die, en broda must mari en wife, so dat e go fit born pikin for en broda wey don die.'

25 “Yu si, e get sevun brodas wey dey stay here wit us. Di first won mari, lata e kon die, since e nor get pikin, en broda kon mari en wife.

26 “Di same tin hapun to di sekon broda and di ted won, go rish di numba sevun.

27 “At last, di wuman kon die tu.

28 “Wen piopl wey don die go kom bak to life, wish pesin wife di wuman go bi out of di sevun brodas wey mari am? “

29 Jisos kon ansa dem, "Una dey mak mistak, bikos una nor no God wod and en pawa.

30 “For resureshon day, pipol nor dey mari or giv wuman out for marage, bikos dem go bi laik angel for hevun.

31 “Konsanin weda pesin wey don die go kom bak to life, una neva read wetin God tel una?

32 “God sey, 'I bi Abraham, Izik and Jakop God. I nor bi God for pipol wey don die, bot I bi God for pipol wey dey alaif!' “

33 Wen di crowd hear as Jisos dey tok, dem sopraiz for wetin e dey tish.

34 Wen di Farisi pipol hear sey Jisos don mak di Sadusi pipol kwayet, dem kon gada.

35 Won of dem wey bi law tisha kon ask Jisos won kweshon to tak trai am.

36 “Tisha, wish komandment big pas? “

37 Jisos kon ansa, "Mak pesin luv God wit all en heart, wit all en soul and wit all en maind.

38 “Na dis bi di first komandment and naim big pas.

39 “Di sekon won bi laik di first won: 'Mak pesin luv en nebor as e luv ensef.'

40 “Na dis tu komandments, Mosis law and wetin di profets tish, dey folo. “

41 As di Farisi pipol gada, Jisos kon ask dem won kweshon.

42 “Wetin una tink abaut Kraist, wey bi di Mesaya? Wish pesin pikin e bi? “Dem kon ansa, "Na David Pikin. “

43 Jisos kon ask dem again, "Den, haw kom David kol am, 'Oga', tru God Spirit, wen e sey,

44 “Di OGA tel my Oga sey,'Sidan for my rite hand, ontil I go put all yor enemis unda yor leg.'

45 “If David kol am, 'Oga,' den, haw e kom tak bi en pikin? “

46 Non of dem fit ansa Jisos, so from dat day go, nobodi trai to ask am kweshon again.

Open Bible reader