Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 16

1 Di Farisi and Sadusi pipol kom test Jisos. Dem ask am mak e show dem sign from hevun.

2 Bot Jisos tel dem, "Wen evenin rish, una go sey, 'Di weda go gud bikos di skai red,'

3 and for mornin, una go sey, 'Rain go fal bikos di skai red and dak.' Una sabi yuz di skai no haw weda go bi, bot una nor fit no di signs abaut di taim wey God tok for en wod.

4 “Wiked and evil pipol of dis taim dey ask for sign, bot dem nor go get eni, esept Jona sign. “Den Jisos kon waka liv dem.

5 Wen di disaipols kros go di oda side, dem forget to tak bread folo bodi.

6 Jisos kon tel dem, "Mak una gaid unasef against di Farisi and Sadusi pipol yist. “

7 So dem kon dey tok among demsef sey, "Na bikos wi nor bring bread, naim mak am dey tok laik dis. “

8 Wen Jisos no wetin dem dey tok, e kon tel dem, "Una fite smol o! Wetin mak una dey kworel wit unasef sey una nor tak bread folo bodi?

9 “So una neva stil undastand? Una nor rimemba di faiv bread wey I tak fid faiv tazon men and haw meni basket una gada afta dem don chop finish?

10 “Or di sevun bread for di for tazon men and haw meni basket una gada afta dem don chop finish tu?

11 “Why una nor undastand sey I nor dey tok to una abaut bread? Bot na mak una for gaid unasef against wetin di Farisi and Sadusi pipol dey tish! “

12 Den di disaipols kon no sey nor bi bikos of bread mak am dey warn dem, bot na bikos of di tins wey di Farisi and Sadusi pipol dey tish.

13 Wen Jisos Kraist rish Sizeria for Filippi aria, e kon ask en disaipols, "Na hu pipol sey Man Pikin bi? “

14 Dem kon ansa, "Some pipol sey yu bi Jon di Baptist, odas sey yu bi Elija and som dey sey na Jeremia or won oda profet naim yu bi. “

15 Jisos kon ask dem, "Hu una sey I bi? “

16 Saimon Pita kon ansa, "Yu bi di Mesaya, God Pikin wey dey alaif. “

17 Den Jisos tel am, "God go bless yu, Saimon, Jona pikin, bikos na my Papa for hevun show yu dis tin, nor bi humanbin.

18 “And I tel yu, yu bi Pita, wey min rock, and on-top dis rock, I go build my shosh and di gate for hell nor go fit skata am.

19 “I go giv yu hevun key, so dat enitin wey yor praya tie for eart, dem go tie am for hevun and enitin wey yor praya luz for dis eart, dem go luz am for hevun. “

20 Den Jisos orda en disaipols mak dem nor tel enibodi sey, na-im bi di Mesaya.

21 From dat taim go, Jisos kon dey tel en disaipols sey, en must enta Jerusalem wer di eldas, prist oga dem and di law tishas go sofa and kil-am, bot for di ted day, e go wak-up.

22 So Pita tak Jisos go won kona kon tel am, "Oga! God forbid! Dis kaind tin nor go eva hapun to yu! “

23 Bot Jisos turn face Pita kon sey, "Satan, komot for my front! Yu bi stone wey blok road, bikos yor maind nor dey for wetin God wont, bot na wetin man wont. “

24 Den Jisos tel en disaipols, "If enibodi won folo mi, e must denai ensef, kari en kros and folo mi.

25 “Enibodi wey won save en life, go luz am, bot enibodi wey luz en life bikos of mi, go gain am.

26 “Wetin pesin go gain, if di hol wold bi en own, bot e luz en soul? Or wetin pesin go fit giv tak pay for en soul?

27 “God Pikin and en angels go kom wit en Papa glori, den e go riwod evribodi akordin to dia wok.

28 “I tel una tru wod, som of una dey here wey nor go die, bifor God Pikin go kom bak wit en kindom."

Open Bible reader