Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 15

1 Some Farisi pipol and law tishas kom mit Jisos for Jerusalem ask am,

2 “Why yor disaipols nor dey obey awa eldas tradishon? Dem nor dey wosh dia hand bifor dem chop. “

3 Jisos kon ansa dem, "Why una nor dey obey God komandment, na bikos una won kip una tradishon?

4 “God sey, 'Respet yor papa and mama, enibodi wey kos en papa or mama, dem must kil-am.'

5 “Bot una sey, 'If enibodi tel en papa or mama, "Wetin I won giv yu bifor, I don gi-am to God",

6 den e nor nid to respet en papa again.' Bikos of una tradishon, una don mak God wod yeye.

7 “Una wey dey pritend! Tru-tru, na una Profet Isaia tok abaut wen e sey,

8 'Dis pipol dey praiz mi wit dia mout, bot dia heart dey far from mi

9 and di woship wey dem dey giv mi, dey yuzles, bikos dem dey tish tradishon wey humanbin get.' “

10 Den Jisos gada di pipol kon dey tish dem, "Mak una listin so dat una go undastand.

11 “Nor bi wetin pesin chop dey mak am dirti, bot na wetin e tok from en mout. “

12 Den di disaipols kon mit am sey, "Yu no sey di Farisi pipol dey ves bikos of wetin yu tok? “

13 Jisos kon ansa, "Eni plant wey my Papa for hevun nor plant, dem go root am komot.

14 “Leav dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, tu of dem go fal insaid gutta. “

15 Bot Pita tel Jisos, "Tel us wetin yu min. “

16 Jisos ansa, "Afta evritin wey I don tok so, una nor stil undastand?

17 “Una nor no sey enitin wey pesin chop enta bele, e go shit-am kom out?

18 “Bot di tins wey dey kom out from pesin mout, dey kom from en heart and na dis tins dey mak di pesin dirti.

19 “Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and dis tins dey mak dem kil, slip wit hu dem nor mari, tif, lai and to joj pesin for en bak.

20 “Na all dis tins dey mak pesin dirti, nor bi bikos pesin chop wit en hand wey e nor wosh. “

21 Afta Jisos komot der, e kon go Tyre and Sidon aria.

22 For der, won Kanan wuman krai kom mit am sey, "Oga, David Pikin, mak yu sori for mi! My dota nor wel, bikos dimon dey trobol am! “

23 Bot Jisos nor tok. So en disaipols kon beg am, "Driv dis wuman komot for here, bikos e dey disturb us.“

24 Jisos kon tel di wuman, "Na di ship wey loss among Izrel pipol, naim God send mi kom faind. “

25 Di wuman nil dan for en front kon dey beg am sey, "Oga, mak yu help mi! “

26 Jisos kon tel am, "E nor gud to giv dog di bread wey shildren sopoz to chop. “

27 Den di wuman ansa, "Yes Oga, Bot di dog demsef dey chop di smol-smol bread wey dey fal from dia oga tabol. “

28 So Jisos tel am, "Madam, yor fate big wel-wel! Mak wetin yu dey faind rish yor hand. “Dat same taim, di pikin kon wel.

29 Jisos komot from der go Galili wotasaid. Den e klimb won mountin go sidan.

30 Meni pipol kon kari pipol wey nor fit waka, blind, paralaiz, dumb and odas wey get difren siknes kom en front and e heal all of dem.

31 Di pipol kon sopraiz wel-wel wen dem si hu nor fit tok, dey tok, hu nor fit waka, dey waka, hu blind bifor, dey si naw and all of dem kon praiz Izrel pipol God.

32 Jisos kol en disaipols kon tel dem, "I dey sori for dis pipol bikos dem don dey here wit mi for tiri days and dem nor get enitin to chop. I nor wont mak dem go bak wit hunga, mak dem nor go faint for road. “

33 Di disaipols kon ansa, "As dis pipol plenti so, wer wi go fit get fud wey go rish dem chop for dis desert?“

34 Jisos kon ask dem, "Haw meni bread una get? “Dem ansa, "Na sevun and som smol-smol fish. “

35 So, Jisos tel di pipol mak dem sidan for groun,

36 kon tak di sevun bread and di fish. Afta e don tank God, e divid di bread giv en disaipols mak dem share am for di pipol.

37 Di pipol chop kon beleful and di fud wey rimain, ful sevun basket.

38 Di men wey chop na for tazon, ivun doh dem nor kount wimen and shildren join dem.

39 Afta Jisos Kraist don send di pipol go dia haus, e kon enta boat go Magadan aria.

Open Bible reader