Nigerian Pidgin Bible
Mark 11
1 As Jisos and en disaipols won enta Jerusalem, dem kon rish Betpage and Betani wey near Mount Olives, so Jisos send en tu disaipols go for dia front
2 kon tel dem, "Mak una go di vilage wey dey for front. As una enta, una go si won smol donkey wey dem tie for der, wey enibodi neva ride bifor. Mak una luz am kom.
3 "If enibodi ask una, 'Why una dey luz am?' Mak una sey, 'Di oga nid am naw. Wi go bring am bak leta.'"
4 So dem go kon si smol donkey wey dem tie near won door for road and dem kon luz am.
5 Som pipol wey stand for der kon ask dem, "Why una dey luz dat smol donkey?"
6 Dem kon tok as Jisos sey mak dem tok, so di pipol kon let dem go.
7 Dem bring di smol donkey kom mit Jisos kon spread dia klot on-top am, den Jisos kon sidan put.
8 Meni pipol spread dia klot for road and som oda pipol spread palm leafs wey dem kut from bush.
9 Di pipol wey dey front and di wons wey dey folo am for bak kon dey shaut, "Hosanna! God don bless di King wey dey kom wit en name.
10 "God don bless awa papa David kindom wey dey kom. Hosanna, wi hail o-o!"
11 Jisos enta Jerusalem kon go insaid di Tempol. Afta e don luk evritin wey dey der, e kon go Betani wit en twef disaipols, bikos day don dey dak.
12 Di next day, as dem dey komot for Betani, Jisos kon dey hungri.
13 E si won fig tri from far wey get plenti leafs, so e kon waka go luk weda frut dey for di tri. Wen e rish der, e si sey nor-tin dey di tri, na onli leafs e get, bikos fig season neva rish.
14 E kon tel di tri, "Pipol nor go eva chop yor frut again." And en disaipols hear wetin e tok.
15 Wen dem rish Jerusalem, Jisos enta di Tempol kon driv all di pipol wey dey sel and buy for di Tempol varanda. E trowey di pipol wey dey shange moni tabol and di pipol wey dey sel bird, e trowey dia chair tu.
16 Jisos nor let enibodi tak enitin wey dem dey sel pas di Tempol varanda.
17 Den e tel dem, "Dem rite am sey; 'Pipol go kol My haus, "Praya haus" for di hol wold. Bot una don turn am to tifi-tifi haus.'"
18 Wen di prist oga dem and di law tishas hear wetin e tok, dem kon dey plan haw dem go tak kil Jisos, bot dem dey fear, bikos di pipol sopraiz for wetin e dey tish dem.
19 Wen evenin rish, Jisos and en disaipols kon komot for di tawn.
20 For mornin, wen Jisos and en disaipols dey pas, dem kon si sey di fig tri don dey die from en root.
21 Pita rimemba kon tel Jisos, "Tisha, luk! Di fig tri wey yu kos yestiday don dey die."
22 Jisos kon tel dem, "Mak una get fate for God.
23 "I tel una tru wod, if enibodi tel dis mountin, 'Komot from here go enta di sea' and di pesin nor get doubol maind, bot biliv sey wetin e tok go hapun, God go du-am for am.
24 "Na dis mak mi dey tel una sey, enitin wey una pray and ask God for, mak una biliv sey una don get-am and e go bi una own.
25 "Enitaim una dey pray, if una get enitin for maind against enibodi, mak una forgiv am, so dat una Papa wey dey hevun go forgiv una tu.
26 "Bot if una nor gri forgiv oda pipol, una Papa wey dey hevun nor go forgiv una."
27 Jisos and en disaipols go Jerusalem again. Wen Jisos dey waka for di Tempol varanda, di prist oga dem, di law tishas and di eldas kom mit am sey,
28 "Na wish rite yu get to tak dey du all dis tins? Hu giv yu di pawa?"
29 Jisos ansa dem, "I go ask una won kweshon. If una ansa mi, den I go tel una wish rite I get to dey du dis tins.
30 "Jon baptism, na from God, abi na from pipol e from kom? Mak una ansa mi."
31 Dem kon dey tok to ish oda, "If wi sey, 'Na from God,' e go sey, 'Den why una nor biliv am?'
32 "Bot wi nor fit sey, 'Na from pipol', bikos wi dey fear dis pipol, (since dem biliv sey Jon na profet)".'
33 So dem ansa Jisos, "Wi nor no." Den, Jisos sey, "Mi tu nor go tel una hu giv mi di pawa to du all dis tins."