Nigerian Pidgin Bible
Malachi 1
1 Na the message wey God give Malachi make he tell people of Israel be this.
2 God tell him people say, I love una. But dem reply say, How you don show your love to us? God answer say, Esau and Jacob na brothers, but I love Jacob and him descendants,
3 and I hate Esau and him descendants. I don destroy Esau hill country and I don leave am for vox.
4 If Esau descendants, the Edomites talk say, Our towns don destroy, but we go rebuild them, then God go reply say, Make dem rebuild I go tear them down again. People go call them The evil country and The Nation wey God dey vex with forever.
5 The people of Israel go see am with their own eyes, and dem go say, God get power even outside land of Israel!
6 God Almighty tell the priests say, A son dey honor him father, and a servant dey honor him own master. I be una father - why una no honor me? I be una master - why una no respect me? Una hate me and yet una dey ask, How we don hate you?.
7 Na like this una dey bring unclean offering come my alter. And una dey ask, how we don fail to respect you? I go tell una as una no dey show respect for my alter.
8 When una bring a blind or sick or lame animal con use do sacrifice to me, shey una think say nothing dey wrong with that? Make una try give that kind animal to the governor! Shey him go dey happy with una and do favor for una?
9 Now, you priests dey try ask God make he dey good to us. He no go answer una prayers, and na una fault e go be.
10 God almighty talk say, I wish say one of una fit close the temple doors, so that una no go fit light una useless fire on top my alter. I no dey happy with una, I no go accept offering wey una bring to me.
11 People from one end of the world to the other dey honor me. Na everywhere dem dey burn incense to me and offer good sacrifices. All of them dey honor me!
12 But una dishonor me, when una talk say my alter no get value and when una offer unclean food on top am.
13 Una smell the food and una no fit eat am, una talk say e don spoil and una bring animal wey sick and cripple, and animal wey get wound con give me for sacrifices, but I no accept them. Na wetin Almighty God talk be this.
14 Some people get better, male animals wey dem fit give as sacrifices, but dem no give. Some of una bring better animals and promise say una go give dem to me, but dem change am for secret and give me the one wey don sick. Bad thing go happen to those people. I be the Great King, and people of all nation dey fear me.