Nigerian Pidgin Bible
Luke 9
1 Afta Jisos don kol di twef disaipols togeda, e giv dem pawa and autoriti to driv dimon and to heal pipol wey nor wel.
2 Den e kon send dem go prish abaut God Kindom and heal pipol wey nor wel.
3 E tel dem, "Mak una nor tak wokin-stik, bag, bread, moni or extra klot folo bodi.
4 Mak una stay for eni haus wey una enta ontil una komot for dat aria.
5 Wer dem nor welkom una, mak una shake di sand from una leg as una dey komot and dis go bi witnes against dem."
6 Di disaipols kon travol go all di vilage dem, dey prish di Gud News and heal pipol for evriwer.
7 Wen Herod wey bi rula hear abaut evritin wey dey hapun, e konfuz, bikos som pipol sey Jon don wak-up from deat
8 and odas sey Elija don apier, som stil sey won old profet don wak-up.
9 Herod kon sey, "I orda mak dem kut Jon head komot, bot hu bi dis won wey I dey hear all dis tins abaut so?" Bikos of dat, Herod kon trai to faind out more abaut Jisos.
10 Wen di apostols kom bak, dem tel Jisos evritin wey dem don du. Den Jisos tak onli dem folo bodi go Betsaida.
11 Bot wen pipol no, dem kon folo Jisos and en disaipols go der. E welkom dem, den tel dem abaut God Kindom and e heal doz wey nor wel.
12 Wen day don dey dak, di disaipols kon tel Jisos, "Tel dis pipol mak dem go, so dat dem go-go di vilage and farm wey near dis aria go fine fud chop, kon slip for der, bikos dis place na desert."
13 Bot Jisos ansa, "Mak una giv dem fud chop." Dem kon sey, "Na onli faiv bread and tu fish wi get, unles yu wont mak wi go buy fud for all of dem.
14 (Di men wey dey der alone rish faiv tazon). Jisos tel en disaipols, "Tel di pipol mak dem sidan fifti-fifti."
15 Di disaipols du as Jisos tok and all di pipol kon sidan.
16 Den Jisos tak di faiv bread and tu fish, e luk hevun, tank God, den e kon divide dem. E giv di bread and fish to en disaipols, mak dem share am for di pipol.
17 Evribodi chop beleful and wen dem gada di fud wey rimain, e ful twef basket.
18 As Jisos dey pray alone and en disaipols dey near am, e kon ask dem, "Na hu pipol dey tok sey I bi?"
19 Dem ansa, "Som sey yu bi Jon di Baptist, odas sey yu bi Elija and odas stil sey yu bi won old profet wey wak-up from deat."
20 Den Jisos ask dem, "Bot hu una tok sey I bi?" Pita kon ansa, "Yu bi di Mezaya wey God send."
21 Bot Jisos warn dem wel-wel, mak dem nor tel enibodi abaut am.
22 Den Jisos tel dem, "God Pikin go sofa meni tins: di eldas, prist oga dem and di law tishas go rejet am, dem go kil-am and afta tiri days, God go wak-am up."
23 So Jisos tel all of dem, "If pesin won folo mi, e must forget ensef, kari en kros evriday, dey folo mi.
24 "Bikos enibodi wey won save en life, go luz am and enibodi wey luz en life bikos of mi, go save am.
25 "Wetin pesin go gain if e get di hol wold, bot e luz en soul?
26 "Enibodi wey dey shame for mi and my wod, Man Pikin go shame for am wen e go kom bak for en glori and di glori wey en Papa and di angels get.
27 "Bot I tel una tru wod, som pipol wey stand for here nor go die, bifor dem go si God Kindom."
28 Won wik afta Jisos tok all dis tins, e kon tak Pita, Jon and James go on-top won mountin go pray.
29 As e dey pray, en face shange and en klot kon dey shine laik lite.
30 At wons, Mosis and Elija kon dey tok wit am.
31 As dem apier wit glori, dem kon tel Jisos haw e go sofa and die for Jerusalem, as dem rite for God wod.
32 Pita and di odas wey dey wit am dey slip bifor, bot at wons slip komot from dia eye and dem si Jisos glori and di tu men wey stand wit am.
33 Den as Mosis and Elija won go, Pita kon tel Jisos, "Oga, e gud mak wi stay here. Mak wi build tiri kanopi, won for yu, won for Mosis and won for Elija.' (Pita nor ivun no wetin e dey tok.)
34 As e stil dey tok, won kaind kloud suroun dem, fear kon kash di disaipols, as Mosis and Elija enta di kloud.
35 Won vois from di kloud kon sey, "Dis na my pikin wey I shuz. Mak una listin to am!"
36 Afta di vois don tok finish, Jisos kon dey alone for di place, bot di disaipols kwayet and dem nor tel enibodi wetin dem si.
37 Di next day wen dem kom dan from di mountin, meni pipol kom mit Jisos.
38 Den won man among di pipol krai kom, "Tisha, I beg yu, si my pikin, na-im bi di onli boy wey I get!
39 "Evil spirit dey wori am and e dey mak am shaut. Di spirit dey mak am get konvoshon and foam dey komot for en mout. Di spirit nor gri liv am and e dey trobol am wel-wel.
40 "I beg yor disaipols mak dem driv di dimon komot, bot dem nor fit."
41 Jisos kon tel dem, "Una wey dey du bad tins and nor gri biliv, haw long I go stay wit una?" Den e tel di man, "Bring yor pikin kom here."
42 As di boy dey kom, di dimon trow am for groun and konvoshon kon hol am. Den Jisos komand di dimon mak e komot and e heal di boy, kon gi-am to en papa.
43 Den evribodi wey dey der kon sopraiz as dem si God pawa. Bot as di pipol stil dey sopraiz, Jisos kon tel en disaipols,
44 "Mak una nor forget wetin I won tel una, dem go sel God Pikin giv humanbin."
45 Bot dem nor undastand dis wod, bikos God hide am from dem mak dem for nor no wetin di wod min. Di disaipols demsef dey fear to ask Jisos abaut di mata.
46 Di disaipols kon dey ask demsef, "Hu big pas among us for God Kindom?"
47 Wen Jisos no wetin dem dey tok, e bring won smol pikin near am
48 kon tel dem, "Enibodi wey welkom dis smol pikin bikos of mi, don welkom mi and enibodi wey welkom mi, don welkom God wey send mi, bikos di pesin wey smol pas among una, na-im big pas for God Kindom."
49 Jon tel Jisos, "Oga, wi si won man dey driv dimon wit yor name and wi tel am mak e stop, bikos e nor dey wit us."
50 Jisos kon ansa am, "Nor stop am, bikos enibodi wey nor dey against us, dey awa side."
51 Wen di taim wey God go tak Jisos go hevun don near, Jisos tink for en maind sey, e go-go Jerusalem.
52 E kon send mesenjas go for front and dem enta won vilage for Samaria go priper evritin bifor e go rish der,
53 bot di villagas nor gri welkom am, bikos dem si sey, e won go Jerusalem.
54 Wen James and Jon si wetin hapun, dem kon sey, "Oga, yu wont mak wi kol fire dan from hevun kon kil dis pipol?"
55 Bot Jisos turn warn dem,
56 den en and dem kon go anoda vilage.
57 As Jisos dey go for road, won man kon tel am, "I won folo yu go eniwer wey u dey go."
58 Jisos kon tel am, "Rabbits get hol, birds get nest, bot Man Pikin nor get eniwer to put en head!"
59 Jisos kon tel anoda man, "Mak yu folo mi," bot di man sey, "Oga, mak I first go bere my papa."
60 Jisos kon tel am, "Mak doz wey don die, bere hu don die. Bot mak yu go prish abaut God Kindom."
61 Anoda pesin kon sey, "Oga! I go laik to folo yu, bot mak I first go tel my famili bye-bye."
62 Jisos tel am, "Pesin wey put hand for dis wok, den kon dey luk bak, nor get part for God Kindom."