Nigerian Pidgin Bible
Luke 5
1 Jisos stand near Genesaret and pipol gada mak dem for hear God wod.
2 E si tu kenu for di wotasaid, bot di fishamen wey get dem, don kom dan dey wosh dia net.
3 E enta insaid won kenu wey bi Saimon Pita own kon tel am mak e push di kenu enta wota smol. Den Jisos kon sidan dey tish di pipol from di kenu.
4 Wen e don tok finish, e kon tel Saimon, "Push di kenu go wer deep pas for di wota, mak una for fit kash fish."
5 Saimon ansa, "Oga, wi dey here from nite til day-break and wi nor kash enitin. Bot as yu tok, wi go put awa net insaid wota."
6 So, dem trow dia net insaid wota and dem kash meni fish sotey dia net kon start to tear.
7 So, dem kon du sign giv di oda pipol wey dey folo dem wok, mak dem kom help dem. Wen dem put all di fish insaid di tu kenu, di kenu dem kon dey won sink.
8 Wen Saimon si wetin hapun, e kon nil dan for Jisos front dey sey, "Abeg, nor near mi Oga, bikos I bi sina."
9 Pita and all di pipol wey dey wit am sopraiz wel-wel wen dem si all di fish wey dem kash.
10 James and Jon, wey bi Zebedi shildren, wey dey folo Pita wok, sopraiz tu. Den Jisos tel Saimon Pita, "Mak yu nor wori, from today go, na pipol yu go dey kash."
11 So wen dem don push dia kenu rish groun for di wotasaid, dem liv evritin kon folo Jisos.
12 Wen Jisos dey for won tawn, won man wey get leprosi kom mit am. Wen di man si Jisos, e fal face groun kon beg-am sey, "Oga, if yu laik to du-am, yu go fit heal mi."
13 So Jisos tosh di man kon sey, "I laik to du-am. 'Oya! Mak yor bodi klin naw!'" At wons, di leprosi komot for di man bodi.
14 Jisos tel di man, "Mak yu nor tel enibodi, bot go show yorsef to di prist and pay di ofrin wey Mosis komand sey, pipol wey dia leprosi don komot for dia bodi go bring, so dat di prist go no sey yu don rili wel."
15 Bot di news abaut Jisos kon spread pas bifor and meni pipol kom mit am mak dem for fit hear en wod and mak e for heal dem.
16 Bot Jisos komot go pray for widanes, wer pipol nor dey.
17 Won day, wen Jisos dey tish, som Farisi pipol and di law tishas kon kom from all di vilage wey dey Galili, Judea and Jerusalem, dem sidan near Jisos and God pawa dey wit am to heal pipol.
18 Som men kari won man for bed wey nor fit waka, kom. Dem kon dey trai to kari am enta di haus kom mit Jisos,
19 bot bikos pipol meni, dem nor fit kari am pas, so dem kon opun di zink for di haus top, drop di man wit di bed smol-smol, til e rish Jisos front for di pipol senta.
20 Wen Jisos si haw dia fate big rish, e kon tel di man, "My frend, I forgiv yu all yor sins."
21 So di law tishas and di Farisi pipol kon dey tink for dia maind sey, "Hu bi dis man wey dey shalenge God laik dis? Hu fit forgiv sin esept God?"
22 Jisos no wetin dem dey tink, so e ask dem, "Why una dey tink laik dis sef?
23 "Wish won eazi to tok? 'I forgiv yu yor sin?' or 'Get up mak yu waka?'
24 "Bot mak una for no sey Man Pikin get pawa for dis wold to forgiv sin, e kon tel di man wey nor fit waka, 'I tel yu, get up, kari yor bed mak yu dey go haus.'"
25 At wons, di man kon get up for dia present, kari di bed wey e laidan put bifor kon dey praiz God as e dey go haus.
26 Evribodi for der sopraiz wel-wel. Fear kash dem and dem kon dey wonda dey sey, "Na wondaful tin awa eye si today so -o-o!"
27 Afta dis won, Jisos go out and e kon si won tax koletor sidan for wer e for dey kolet tax, en name na Levi. Jisos kon tel am, "Mak yu folo mi."
28 Levi get up, liv evritin kon folo am.
29 Den Levi du parti for en haus bikos of Jisos, so meni tax koletors and oda pipol kom chop wit dem for di parti.
30 Bot di Farisi pipol and som law tishas kon dey ves for Jisos disaipols sey, "Why una dey chop and drink wit tax koletors and sinas?"
31 Jisos ansa dem, "Pipol wey wel nor nid doktor, na onli doz wey nor wel, nid am.
32 "I nor kom kol gud pipol to turn from sin kom mit God, bot na sinas, I kom kol."
33 Den som pipol kon tel Jisos, "Jon disaipols dey fast and pray and di Farisi disaipols dey du di same tin, bot yor own jos dey chop and drink enihaw."
34 So Jisos ansa dem, "Yu espet sey mak pipol wey kom marage dey hungri wen di man wey dey mari dey der?
35 Bot taim go rish wen di man wey dey mari nor go dey wit dem, dat taim, dem go fast."
36 E stil tel dem won parabol: "Nobodi dey tear new klot tak pash old won. If e du laik dat, e go fit spoil di new klot and di new klot pisis nor go mash di old won.
37 "And nobodi dey pour new wine insaid old wine bag. If e du laik dat, di new wine go tear di bag, di wine go trowey and di bag go skata.
38 "Insted, pipol sopoz pour new wine insaid new wine bag.
39 "Nobodi go laik to drink new wine afta e don drink old wine. Bikos e go sey, 'Na di old wine beta pas.'"