Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Luke 24

1 For earli mornin for di first day for di wik, di wimen kari di perfume wey dem priper go di grave wer dem bere Jisos put.

2 Dem kon si sey dem don rol di stone komot from di grave mout,

3 bot wen dem enta insaid, dem nor si Jisos bodi for der.

4 As dem dey konfuz bikos of dis tin, dem kon si tu men wey dia klot dey shine laik lite and dem stand for kona.

5 Fear kash di wimen and dem kon face groun. Bot di men tel dem, "Why una dey faind pesin wey dey aliaf for wer dead bodi dey?

6 "E nor dey here again, God don wak-am! Una rimemba wetin e tel una wen e dey Galili sey,

7 'Dem must sel Man Pikin giv wiked pipol and dem go kil-am trowey and for di ted day, e go wak-up.'"

8 Den di wimen kon rimemba wetin Jisos tel dem,

9 so dem komot from di grave kon go tel di ilevun apostols and di res pipol wetin hapun.

10 Na Mary Magdalene, Joana, Mary wey bi James mama and di oda wimen wey dey wit dem, na dem tel di apostols all dis tins.

11 Bot dia wod nor min enitin to di apostols, so dem nor biliv di wimen.

12 Bot Pita kon get-up, run go di grave. E ben-dan luk insaid and e si onli di klot, den e kon go haus dey wonda wetin hapun.

13 Dat day, tu Jisos disaipols dey waka go won vilage wey dem dey kol Emmaus, wey nor tu far from Jerusalem.

14 Dem dey tok to ish oda abaut di tins wey hapun.

15 As dem dey tok, Jisos kon bigin waka wit dem,

16 (bot Jisos nor let dem no hu e bi.)

17 Den Jisos kon ask dem, "Na wetin mak una dey tok laik dis for road?" Dem kon stand for won place, dey sopraiz for am.

18 Den won of dem, wey en name bi Kleopas, kon ask am, "Na onli yu bi strenja for Jerusalem wey nor no di tins wey dey hapun since?"

19 Jisos ansa dem,"Wish tins?" Dem ansa, "Di tins abaut Jisos wey kom from Nazaret, won man wey wetin e dey tok and du show sey en na God profet

20 and haw awa prist oga dem and di pipol wey dey rule us kil-am trowey.

21 "Bot wi bin hope sey naim go fri Izrel and dis tins don hapun for tiri days naw.

22 "Som wimen wey dey wit us kon ivun sopraiz us. Dem go wer dem bere am put dis mornin

23 and dem nor si en bodi for der. Dem kom bak dey tok sey dem si angels wey tel dem sey Jisos dey alaif.

24 "Den som pipol wey dey wit us kon go di grave and dem si evritin as di wimen tok, bot dem nor si Jisos."

25 So Jisos tel dem, "Una nor get sense and una nor dey kwik biliv wetin all di profets tok.

26 "Dem nor tok sey di Mezaya go must sofa all dis tins and den e go enta en glori?"

27 Den e kon yuz wetin Mosis and all di profets rite tak tel dem wetin God tok abaut am for en wod.

28 As dem near di vilage wey dem dey go, Jisos kon du laik sey e won waka go front,

29 bot dem kon tel am, "Mak yu stay wit us, bikos evenin don nearli rish and day go soon dak." So Jisos enta di vilage kon folo dem stay.

30 E sidan for wer dem dey chop, tak bread, bless am kon divide am giv dem.

31 At wons dia eye opun and dem kon no am. Den e vanish from dia front.

32 Dem kon tel ish oda, "No wonda e bi laik sey fire dey burn insaid awa heart wen e dey tok wit us for road abaut God!"

33 So dem get up at wons go bak to Jerusalem. Dem kon si di ilevun apostols and di oda pipol wey dey wit dem

34 kon tel dem, "Jisos don rili wak-up and e don apier to Saimon!"

35 Den dem kon tok wetin hapun for road and haw dem tak no Jisos wen e divide di bread.

36 As dem stil dey tok, Jisos kon stand wit dem, tel dem, "Mak peace dey wit una."

37 Bot dem shok and fear kash dem, bikos dem tink sey na spirit dem dey si.

38 Den Jisos kon sey, "Why una dey fear and nor biliv?

39 "Mak una luk my hand and leg and mak una tosh mi: spirit nor get flesh and bone as una si sey I get."

40 Wen Jisos don tok dis won, e kon show dem en hand and leg.

41 And as dem neva stil biliv (bikos of dia hapines) and stil dey sopraiz, Jisos ask dem, "Una get enitin to chop for here?"

42 So dem kon gi-am fish wey dem don kook,

43 e kon tak am chop for dia front.

44 Den Jisos tel dem, "Na di wod wey I tel una wen I stil dey wit una bi dis, evritin wey dem rite abaut mi for Mosis law, di profets books and Psalm, must hapun."

45 Den e opun dia maind so dat dem go fit undastand God wod

46 kon tel dem, "Na wetin dem rite bi dis, 'Di Mezaya go sofa and e go wak-up from deat for di ted day

47 and dem go yuz en name prish giv pipol mak dem for turn from dia sin kom mit God and di prishin go start from Jerusalem.

48 "Una bi witnes for dis tins.

49 "I dey send wetin my Papa promis kom mit una. So mak una stay for dis tawn ontil pawa go kom from hevun kon kova una."

50 Den Jisos tak dem go Betani kon lift en hand and bless dem.

51 As e dey bless dem, God kon kari-am go hevun.

52 So, dem woship am kon go bak to Jerusalem dey hapi wel-wel

53 and dem kon dey go di Tempol evritaim, dey praiz God.

Open Bible reader