Nigerian Pidgin Bible
Luke 23
1 Den di Farisi pipol and di oda pipol tak Jisos go mit Pilate,
2 dey akius am sey, "Wi hear dis man wen e dey disiv and tel awa pipol sey mak dem nor pay tax giv Caesar and e dey tok sey naim bi Kraist, wey bi king."
3 Pilate kon ask Jisos, "Na yu bi di Ju pipol king?" Jisos ansa, "Na as yu tok."
4 Den Pilate tel di prist oga dem and di pipol, "I nor si enitin wey go mak mi kondem dis man."
5 Bot dem stil sey, "E dey kause wahala wit wetin e dey tish pipol for Judea. E start am for Galili and naw e don kom here!"
6 Wen Pilate hear dis won, e kon ask weda Jisos na Galili pesin.
7 Wen e hear sey Jisos kom from Jerusalem, wer Herod dey rule for dat taim, e kon sey mak dem tak Jisos go mit am.
8 Wen Herod si Jisos, e hapi wel-wel, bikos e don tey wen e won si-am since e hear abaut am. E dey hope sey Jisos go du mirakol for en present.
9 Herod kon ask Jisos meni kweshon, bot Jisos nor ansa am at-all.
10 Di prist oga dem and di law tishas dey akius Jisos wit vesnashon.
11 Herod wit en sojas tu dey tak Jisos mak yeye and dey laff am. Den Herod sey mak dem wear fine klot for Jisos bodi, den tak am go bak go mit Pilate.
12 Dat day, Herod and Pilate kon bi frends, bikos bifor dis taim dem bi strong enimi.
13 Den Pilate kol di prist oga dem, di eldas and di pipol for dat place
14 kon tel dem, "Una bring dis man kom mit mi sey e dey disiv pipol. Wen I ask am kweshon for una present, I nor si eni bad tin wey una sey e du.
15 "Ivun Herod nor stil si enitin tu, so e sey mak dem bring am kom mit us. Dis man nor du enitin wey go mak am die.
16 "So I go giv orda mak dem flog am, den I go fri am."
17 (Na dia tradishon sey Pilate must riliz won prizina enitaim wen dem dey du Passova Fist.)
18 Bot all of dem kon dey shaut, "Tak dis man komot! Na Barabbas wi wont!"
19 (Barabbas na pesin wey dem put for prizin bikos e kause wahala and kil pesin for di tawn.)
20 Pilate kon tok to dem again, bikos e won fri Jisos.
21 Bot dem stil dey shaut, "Kil-am trowey, Kil-am trowey!"
22 Again Pilate kon ask dem, "Why? Wish bad tin e du? I nor si eni bad tin wey e du wey go mak am die, so I go giv orda mak dem flog am, den I go fri am."
23 Bot dem kon shaut more-more dey sey, "Kil-am trowey." Dem shaut sotey Pilate kon du wetin dem wont.
24 So Palite kon orda mak en sojas giv Jisos to di pipol mak dem kil-am.
25 E kon fri Barabbas, wey di pipol wont, wey dem bin put for prizin, bikos e kause wahala and kil pesin for di tawn.
26 As dem dey tak Jisos komot, dem kon kash won man wey dey kom from Syrene and en name na Saimon. Dem put di kros for en bak mak e kari am folo Jisos.
27 Meni pipol folo Jisos and di wimen among dem kon dey krai.
28 Bot Jisos turn luk dem sey, "Jerusalem wimen, mak una nor krai bikos of mi, bot mak una krai for unasef and for una shildren.,
29 "Bikos tru-tru, di taim dey kom wen pipol go sey, 'E gud wel-wel for wimen wey nor born or fid pikin at-all!'
30 "Den, dem go tel di mountins, 'Mak yu fal on-top us!' And tel di hills, 'Mak yu kova us!'
31 "Bot if dem du dis kaind tin for wud wen e stil fresh, wetin go hapun wen di wud don dry?"
32 Dem stil tak tu oda men wey bi tif, wey dem wont kil, folo Jisos.
33 Wen dem rish di place wey dem dey kol, "Di Skul," dem kon nail Jisos for kros wit di tu tif, won for en left and di oda for en rite side.
34 (Den Jisos kon sey, "Papa, mak Yu forgiv dem, bikos dem nor no wetin dem dey du.") So, di sojas kon gambol to no hu go tak Jisos klot.
35 Di pipol stil stand der dey luk, bot dia ledas dey laff Jisos sey, "E save oda pipol. Mak e save ensef if e bi di Mezaya wey God shuz!"
36 Di sojas stil dey laff Jisos and dem kon gi-am wine wey don sawa mak e drink,
37 den sey, "If yu bi di Ju pipol king, mak yu save yorsef!"
38 Dem kon rite on-top en kros sey, "Dis na, 'Ju Pipol King.'"
39 Won of di tif dey shaut for Jisos, "Nor bi yu bi di Mezaya? Mak yu save yorsef and us naw!"
40 Bot di oda tif kon shaut for di first tif, "Yu nor dey fear God as e bi sey na di same ponishment wi dey sofa?
41 "Na dis ponishment fit us, bikos na wetin wi du naim mak dem dey ponish us so. Bot dis man nor du eni bad tin."
42 Den e kon tel Jisos, "Wen yu rish yur kindom, mak yu rimemba mi!"
43 Jisos ansa am, "I tel yu di trut, today yu go dey wit mi for paradaiz."
44 By naw, twef o' klok don nearli rish for aftanun and daknes kon kova di hol kontri ontil tiri o' klok for dat aftanun,
45 bikos sun stop to shine. Di Tempol kurtain kon tear into tu.
46 So, Jisos shaut, "Papa, I put my spirit for yor hand!" Afta e tok finish, e kon die.
47 Wen di soja oga si wetin hapun, e kon praiz God sey, "Tru-tru, dis man na gud pesin!"
48 So wen all di pipol wey gada dey luk si wetin hapun, dem kon dey krai go dia haus.
49 And evribodi wey no Jisos bifor, stand for far and di wimen wey folo Jisos kom from Galili, si di tins wey hapun.
50 E get won man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatia wey dey Judea. E bi beta pesin wey dey du wetin God laik and e dey wait for di taim wen God Kindom go kom.
51 (E nor gri wit di oda kansol membas wit dia plan and for wetin dem du so.)
52 E go mit Pilate kon ask for Jisos dead bodi.
53 Den e kari di bodi from di kros, wrap am wit linen klot kon put am for di grave wey e dig insaid rock and dem neva bere enibodi for der bifor.
54 Dat day na Friday wen dem dey redi for Sabat serimoni.
55 Di wimen wey folo Jisos from Galili kon folo Josef go si di grave. So dem put Jisos bodi insaid.
56 Den di wimen go haus go priper beta perfume. Bot for Sabat Day, dem kon res as Mosis law tok.