Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Luke 21

1 For insaid di Tempol, Jisos kon si rish pipol dey put dia moni for ofrin box.

2 E stil si won poor wuman wey en husban don die dey put tu koins insaid di box.

3 Jisos kon sey, "I tel una tru wod, di moni wey dis poor widow put so, big pas all di oda pipol own;

4 bikos di rish pipol giv dia ofrin from di plenti moni wey dem get, bot as dis wuman poor rish, e put evritin wey e get."

5 As som pipol dey tok abaut haw di Tempol fine rish, bikos of di stones wey dem tak build am and di ofrin wey pipol dey giv, Jisos kon sey,

6 "Di day dey kom wen all di stones wey una dey si so, go skata and won nor go dey on-top anoda again."

7 So, dem kon ask am, "Tisha, wen dis tins go hapun? And wetin go bi di sign sey di taim for dis tins to hapun don rish?"

8 Jisos ansa, "Mak una shine una eye, so dat nobodi go disiv una. Bikos meni pipol go kom prish wit my name sey, 'Na mi bi Jisos' or 'Di taim don near.' Mak una nor folo dem!

9 "And wen una hear rumor abaut war and wahala, mak una nor fear. Bikos all dis tins go first hapun, bot dat nor min sey di end don rish."

10 Den Jisos tel dem, "Kontri go fite kontri, kindom go fite kindom.

11 "Strong eartquake, hunga and siknes go dey evriwer; difren-difren tins and bad signs go dey hapun and fear go kash evribodi.

12 "Bot bifor dem go hapun, dem go arres and ponish una for wetin una nor du, dem go kari una go joj for insaid sinagog, den dem go trow una insaid prizin. Dem go kari una go mit kings and govnors, bikos of my name.

13 "Dis na di taim for una to spread di Gud News.

14 "So mak una redi una maind bifor di taim rish. Mak una nor tink haw una go tak difend unasef,

15 bikos I go giv una di wod wey una go tok and wisdom wey una enimi nor go fit opoz.

16 "Una papa, mama, brodas, rilashons and frends go sey dem nor no una and dem go ivun kil som of una.

17 "Evribodi go hate una bikos of my name.

18 "Bot God eye go always dey wosh una.

19 "So, if una stand rish di end, God go save una."

20 "Bot wen una si sey sojas don suroun Jerusalem, mak una no sey di taim wey dem go distroi Jerusalem, don near.

21 "So, mak di pipol wey dey Judea run go mountin and doz wey dey insaid tawn must komot der. Mak doz wey dey outsaid, nor enta di tawn again,

22 bikos na dat taim God go joj di wold, since evritin wey dem rite for God wod, must hapun.

23 "Dat taim, e go bad wel-wel for wimen wey get bele or get smol pikin for hand! Strong wahala go kom for dis land and God ponishment go fal for pipol head.

24 "Dem go yuz sword kil som, kari som as prizina go anoda kontri and di Gentai pipol go destroi Jerusalem, ontil di taim wey God sey Izrel must sofa, go end.

25 "Difren-difren signs go show for sun, moon and star. For insaid dis wold, pipol for difren kontris go dey wori and fear, bikos of di way rivas go dey move and wota go dey rush from sea enta land.

26 "Pipol go dey fent and fear go dey kash som, bikos of wetin dey hapun for di wold and difren pawas insaid di skai, go shake komot for wer dem dey.

27 "Den, dem go si Man Pikin dey kom insaid kloud wit pawa and glori.

28 "So, wen dis tins dey hapun, mak una stand and dey redi, bikos una salvashon don near."

29 Den, Jisos kon tel dem dis parabol: "Mak una tink abaut di fig tri and all di oda tris.

30 "Wen dia leaf start to fal komot, mak una no sey dry season don near.

31 "Na so una go stil no tu. Wen una si all dis tins dey hapun, una go no sey God Kindom don near.

32 "I tel una tru wod, di pipol for dis wold naw nor go die finish bifor all dis tins go hapun.

33 "Hevun and eart go vanish komot, bot my wod go dey foreva.

34 "So, mak una shine una eye! Nor let parti and wahala for dis life ful una maind, if not, dat Day go kom wen una nor espet,

35 bikos dat Day go sopraiz evribodi wey dey for dis wold.

36 "Bot mak una dey shine una eye evritiam, dey pray mak God giv una pawa tak pas all dis tests wey go hapun, so dat una go fit stand for Man Pikin front."

37 So, Jisos kon dey tish for di Tempol evriday, bot wen nite rish, e go-go Mount Olives.

38 For earli mornin, all di pipol dey go listin to am insaid di Tempol.

Open Bible reader