Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Luke 20

1 Won day wen Jisos dey tish pipol for di Tempol, di prist oga dem and di law tishas kon mit am,

2 dey sey, "Mak yu tel us, na wish pawa yu tak dey du dis tins? Na hu giv yu di pawa sef?"

3 Jisos ansa dem, "Mak I stil ask una won kweshon and mak una ansa mi.

4 Jon baptism kom from hevun, abi na from pipol?"

5 Dem kon dey tok wit ish oda sey, "If wi sey na from hevun, e go sey, 'Den why una nor biliv am?'

6 "Bot if wi sey, 'Na from pipol', dis pipol go stone us, bikos dem biliv sey, Jon na profet."

7 So dem kon tel Jisos sey dem nor no wer di baptism from kom.

8 Den Jisos tel dem, "Mi tu nor go tel una hu giv mi di pawa to du all dis tins."

9 Jisos kon tel di pipol won parabol: "Won man rent en grape farm giv tenants, den e travol.

10 "Wen havest taim rish, e kon send won savant go mit di tenants mak dem gi-am en share from di havest. Bot di tenants beat di savant kon send am go bak wit empti hand.

11 "So e send anoda savant and dem stil beat and du-am enihaw, den dem kon send am bak wit empti hand.

12 "Di man kon send di ted savant go, bot di tenants wound am kon trow am outsaid tu.

13 "So di owna of di grape farm kon sey, 'Wetin I go du naw? I go send di onli pikin wey I get, may bi dem go respet am."

14 "Bot wen di tenant si di pikin, dem kon sey, 'Na di owna pikin dey kom so, mak wi kil-am, so dat-all di propati go bi awa own!'

15 "Dem kari di pikin go outsaid, kon kil-am. So, wetin una tink sey di owna go du di tenants?

16 "E go kom distroi all dis tenant, den giv di grape farm to new tanants. Wen di pipol hear dis, dem kon sey, 'Mak dis tin nor hapun o-o!'"

17 Bot Jisos luk dem for face kon ask, "Wetin God wod min wen e sey: 'Di stone wey di buildas rejet, don turn to di main stone?'

18 "Enibodi wey fal for dis stone, go break into pisis and di pesin wey di stone fal press, go die."

19 Den di Farisi pipol and di law tishas won kon arres Jisos for dat place, bikos dem no sey Jisos dey tok against dem. Bot dem dey fear di pipol.

20 Den di Farisi pipol and di law tishas kon dey wosh Jisos wel-wel. Dem send som pipol go pritend laik sey dem dey folo Jisos, so dat dem go fit yuz en wod against am, kon ripot am to di Roman Govnor.

21 So dem ask am, "Tisha, wi no sey wetin yu dey tok koret and yu nor dey du wayo, bikos yu dey tish di trut abaut God.

22 "Mak yu tel us, 'E gud mak wi pay tax giv Caesar?'"

23 Bot Jisos no sey na trap, so e kon tel dem,

24 "Mak una show mi di moni. Wish pesin face and name dey?" Dem ansa, "Na Caesar own."

25 So Jisos tel dem, "Den mak una giv Caesar wetin bi Caesar own and mak una giv God wetin bi God own."

26 So dem nor fit get-am wit en wod for di pipol present. Dem sopraiz for di ansa wey e giv and dem nor fit tok again.

27 Den som Sadusi pipol (wey nor biliv sey pipol go wak-up from deat) kom mit Jisos,

28 dey sey, "Tisha, Mosis law sey, 'If pesin die liv en wife and di wuman nor born for am, en broda must mari di wuman wey en husban don die, so dat e go born shildren for di broda wey don die.'

29 "E get won famlili wey get sevun brodas. Di first won mari, bot dem nor born bifor di man die.

30 "Den di sekon won kon mari di wuman,

31 den di ted won, ontil numba sevun die tu, bot di wuman nor stil born for eni of dem.

32 "At last, di wuman kon die tu.

33 "For di day wey pipol go wak-up from deat, wish pesin wife di wuman go bi, since all di sevun brodas mari am?"

34 So Jisos ansa dem, "Pipol for di wod naw dey mari.

35 "Bot di pipol wey God go wak-up from deat kari go hevun, nor go mari.

36 En short, dem go bi laik angels, dem nor go die again. Dem go bi God shildren, bikos dem don wak-up from deat.

37 "Bot ivun Mosis tok sey pipol wey don die go wak-up. Mosis tok laik dis wen e rite abaut haw e kol God, Abraham, Izik and Jakop God, wen e dey di bush wey dey burn.'

38 "Awa God nor bi God for dead pipol, bot na God wey dey alaif, bikos for God eye, evribodi dey alaif."

39 Den som law tishas ansa, "Tisha, yu don tok wel!"

40 So dem nor dare ask Jisos kweshon again.

41 Jisos kon tel dem, "Wetin mak dem sey Mezaya na David pikin?

42 "Bikos David ensef tok for Psalm Book sey, 'Di OGA tel my oga sey, "Sidan for my rite hand,

43 ontil I go put yor enimis unda yor leg. "'

44 "If David kol am 'Oga,' haw e kon tak bi David pikin?"

45 As all di pipol dey listin, Jisos kon tel en disaipols,

46 "Mak una gaid unasef from di law tishas. Dem laik to dey waka wit long klot mak pipol dey shaut dia name for market and chairs wey beta pas for singog, na der dem dey laik to sidan.

47 Dem dey sofa wimen wey dia husban don die and kolet dia tins kon dey pray long praya mak pipol for si dem. Na dia ponishment go big pas."

Open Bible reader