Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 16

1 "I dey tel una all dis tins, so dat nobodi go fit disiv una.

2 "Dem go driv una komot for di sinagog and di taim dey kom wen di pesin wey go kil una, go tink sey e dey du God wok.

3 "Dem go du all dis tins, bikos dem nor no mi and my Papa.

4 "Bot I tel una all dis tins, so dat wen di taim rish, una go rimemba sey I tel una abaut dem bifor. I jos dey tel una all dis tins, bikos I dey wit una since.

5 "Naw, I dey go mit di Pesin wey send mi kom, bot una dey ask mi, 'Wer yu dey go?'

6 "Bot una nor hapi as I dey tel una all dis tins.

7 "I tel una tru wod, na for una own gud naim mak mi won go, bikos if I nor go, di Pesin wey go help una nor go kom, bot if I go, I go send am kom mit una.

8 "Wen e kom, e go show pipol for dis wold wetin sin, God raitiousnes and God jojment, bi.

9 "Di Spirit go show dem sey dem dey wrong abaut sin, bikos dem nor biliv mi.

10 "Dem dey wrong abaut God raitiousnes, bikos I dey go mit my Papa and dem nor go si mi again.

11 "And dem dey wrong abaut jojment, bikos God don kondem di pesin wey dey rule dis wold.

12 "I get plenti tins wey I won tel una, bot una nor go fit bear dem naw.

13 "Bot wen God Spirit kom, e go show una di trut. E nor go tok wetin dey en maind, bot e go tok wetin e hear from God and wetin go hapun afta I don go.

14 "E go dey giv mi glori wen e dey tel una di tins wey e dey hear from mi.

15 "Evritin wey my Papa get, na my own, naim mak mi tok sey di Spirit go tel una wetin e dey hear from mi.

16 "Taim go soon kom wen una nor go si mi, bot afta som taim, una go si mi."

17 Den som of di disaipol kon dey ask ish oda, "Wetin e min wen e sey, 'Taim go soon kom wen una nor go si mi, bot afta som taim, una go si mi bikos I dey go mit my Papa?'"

18 Som of dem stil sey, "Wetin e get for maind wen e sey, 'Taim go soon kom?' Wi nor undastand wetin e dey tok."

19 Jisos si sey dem won ask am abaut wetin e tel dem, naim e ask dem, "Una dey ask ish oda wetin I min wen I sey, 'Taim go soon kom wen una nor go si mi, bot afta som taim, una go si mi?'

20 "I tel una tru wod, una go krai and mourn, bot di wold go dey hapi; una go dey sad wel-wel, bot una sadnes go turn to hapines.

21 "Wen wuman won born pikin, e dey sofa strong pain, bikos en taim to born don rish, bot wen e don born, e go hapi and e nor go rimemba di pain again, bikos e go si sey e don born pikin.

22 "Na so e bi to una naw, bikos una heart dey heavi, bot I go si una again and for dat taim, una go dey hapi and nobodi go fit tak di hapines from una.

23 "By dat taim, una nor go ask mi enitin again. I tel una tru wod sey, enitin wey una ask my Papa wit my name, E go giv una.

24 "Bifor naw, una neva tak my name ask for enitin. Naw mak una yuz my name ask for enitin wey una wont and una go get-am, so dat una joy go ful wel-wel.

25 "Since I dey yuz parabol tok to una; bot di taim dey kom wen I nor go yuz parabol again, bot I go tel una abaut my Papa for di way wey una go undastand.

26 "By dat taim, una go fit ask enitin wit my name and God go du-am for una.

27 "My Papa luv una, bikos una luv mi and biliv sey na-im send mi.

28 "Na my Papa send mi kom dis wold, bot naw, I dey go bak go mit am."

29 En disaipols kon sey, "Yu si, na naw yu dey tok for di way wey wi undastand and nor bi wit parabol.

30 "Naw wi no sey yu no evritin and yu nor nid enibodi to ask yu eni kweshon. Bikos of dis, wi biliv sey na God send yu kom."

31 Jisos kon tel dem, "So una don biliv naw?

32 "Luk, di taim dey kom and e don ivun rish, wen una go skata and evribodi go-go en own way and I go stay alone. Bot I nor dey alone, bikos my Papa dey wit mi.

33 "I don tel una all dis tins, so dat my peace go stay wit una. Wahala ful insaid di wold and sofa dey tu, bot mak una heart dey strong, bikos I don alredi win di wold."

Open Bible reader