Nigerian Pidgin Bible
James 1
1 Mi James, wey bi God and Jisos Kraist savant, dey grit una wey bi di twef tribes wey dey for evriwer for di wold.
2 My brodas and sistas, mak una dey hapi wen una dey face temtashon,
3 bikos una no sey, if una win di temtashon, una patient go strong.
4 And mak una let patient du en wok, so dat una go dey pafet and komplit, den una go gain evritin.
5 Bot if enibodi nid wisdom, mak e ask God wey dey giv am to evribodi. E nor go sey, "No," bot E go giv yu.
6 Di pesin wey dey ask, must get fate and mak en maind nor shake, bikos enibodi wey en maind dey shake, bi laik riva wey strong briz dey blow up and dan.
7 Mak dat pesin nor tink sey e go risiv enitin from God,
8 bikos e get doubol maind and e nor dey stabol for enitin wey e dey du.
9 Eni biliva wey poor, mak e hapi, bikos God don lift am up.
10 Bot pesin wey get moni, mak e nor proud, bikos e go soon perish laik flawa wey dey for bush.
11 As sun dey dry grass and flawa and dia beauti dey die foreva, na so rish pesin go dry, as e dey porshu and luv moni.
12 Di pesin wey fit bear wen problem kom mit am, mak e hapi, bikos e don show sey en fate strong and e go get di krawn wey get life, wey God don promis sey E go giv pipol wey luv am.
13 Mak nobodi tok wen temtashon kom mit am sey, "God dey test mi," bikos nor-tin fit tempt God and God ensef, nor dey tempt enibodi.
14 Bot temtashon dey kom mit pesin wey get bad tins for maind.
15 Wen di bad tins wey e won du, don mature, e go mak am sin and wen sin don grow wel-wel, e go kause deat.
16 My brodas and sistas, mak nor-tin disiv una,
17 bikos evri beta and pafet gift dey kom from God. E dey kom dan from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.
18 As God wont am, E kon born us wit di tru mesage, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.
19 My brodas and sistas, mak una undastand dis tins: Mak una dey listin wel-wel and nor dey kwik tok or ves.
20 Humanbin vesnashon nor dey mak pipol liv di life wey God wont.
21 So mak una rimov una hand from evri dirti and wiked tins kon put una bodi dan to asept God wod wey dem don plant insaid una, bikos e get pawa to save una soul.
22 Mak una nor dey disiv unasef as una dey hear God wod, bot mak sure sey una dey du wetin en wod tok.
23 Pesin wey hear God wod and e nor dey du wetin e tok, bi laik pesin wey dey luk en face for mirror.
24 Wen di pesin luk ensef finish kon komot go out, e go kwik-kwik forget haw en face bi.
25 Bot di pesin wey dey luk God pafet law wey dey fri pipol, dey du wetin di wod tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey du.
26 If enibodi tink sey en dey folo wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey disiv ensef and en religion nor min enitin.
27 Bot beta religion wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shildren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa, bikos dia husban don die. So, mak una kip unasef, so dat dis wold nor go stain una.