Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 10
1 Una don enter trouble! Una make law wey no dey fair to dey oppress my people.
2 Naso una stop the poor to get their right and justice. Naso una take the property wey belong to the widow and orphans.
3 Wetin una go do when God dey punish una? Wetin una go do when he bring disaster on top una from far country? Where una go find help go? Where una go keep una wealth?
4 Una go die for battle or drag una commot as prisoners. Yet the anger of God no go end; him hand go still dey stretch out to punish.
5 God talk say, Assyria! I use Assyria like club take punish those wey I dey vex with.
6 I send Assyria make dem attack nation wey no get god, people wey don vex me. I send them make them rob and steal and match people like dirty wey dey for streets.
7 But the emperor of Assyrian get him own terrible plan for mind. He don determine to destroy plenty nations.
8 He boast say, Everyone of my commanders na king!
9 I don conquer the city of Calno and Carchemish, the cities of Hamath and Arpad. I don conquer Samaria and Damascus.
10 I don stretch out my hand to punish those kingdom wey dey worship idols, idols wey plenty pass those of Jerusalem and Samaria.
11 I don destroy Samaria and all hin idols, and I go do the same thing to Jerusalem and the images wey dem dey worship for there.
12 But God talk say, :When I finish wetin I dey do on top Mount Zion and for Jerusalem, I go punish the emperor of Assyria for all him boast and pride.
13 The emperor of Assyria boast say, Na me do everything myelf. I dey strong and wise and clever. I wipe out the boundary wey dey between nations and I take the supply wey dem don store. I match people wey dey live for there like bull.
14 The nations of the world be like nest of bird, and I gather their wealth easily like say i dey gather egg. Not even a wind sand scare me commot; no beak even open to scream at me!
15 But God talk say, Shey axe fit claim say hin pass person wey dey use am? shey saw dey important pass man wey use am? a club no dey lift up man; na the man dey ljft up club.
16 Almighty God go send disease on those wey chop belle full. Fire wey burn and continue dey burn go dey their body.
17 God, the light of Israel, go become fire. Holy God of Israel go become flame, wey go burn everything commot for single day, even the thorns and thistles.
18 The rich forest and farmland go destroy totally, in the same day wey terrible disease dey destroy person.
19 Na small trees go remain so tey even pikin go fit count them.
20 A time dey come when the people of Israel wey don survive no go rely on nations wey don almost destroy them again. Dem go truly put their trust in the LORD, holy God of Israel.
21 Few of people of Israel go come back to their God Almighty.
22 Even though now plenty people of Israel dey like grain of sand by the sea, na only few go come back. Destruction don dey ready for the people, wey dem fully desrve.
23 Yes, the sovereign LORD Almighty go bring destruction throughout the whole country as he talk say he go do.
24 The sovereign LORD Almighty tell him people wey dey live Zion say, make una no fear the Assyrians, even though dem oppress una as Egyptians dey do.
25 I go punish una for a while, and then I go destroy them.
26 I, the LORD Almighty, I go beat them with my whip as I beat people of of Midian for the rock of Oreb. I go punish Assyria as I don punish Egypt.
27 When that time come, I go free una from power of Assyria, and their yoke no go be burden on una shoulder again.
28 The enemy army don capture the city of Ai! Dem don pass through Migron! Dem leave their supplies for Michmash!
29 Dem don cross the pass and dem dey spend the night for Geba! The people for town of Ramah dey fear, and people for king Saul town of Gibeah don run away.
30 Make una shout people of Gallim! Make una listen, people of Laishah! Answer, people of Anathoth!
31 The people of Madmenah and Gebim dey run for their lives.
32 Today the enemy dey for the town of Nob, and for there dem dey shake their fist for Mount Zion, for the city of Jerusalem.
33 The LORD Almighty go bring them down like branches wey dem cut commot for a tree.the one wey dey proud pass and the one wey high pass among them go be cut down and shame go catch am.
34 God go cut them down as dem dey cut trees in the heart of the forest down with axe, as even the finest trees of Lebanon don fall!