Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 9

1 Di first kovenant show how pipol go woship God for dis wold.

2 Di tent get tu rooms. Di first won wer lantan-stand dey, "Na di Holi Place." Won tabol and di bread wey dem offa giv God, dey der tu.

3 Anoda room wey dem rite, "Holi of Holis", dey for di kurtain bak.

4 Di gold alta wer dem dey burn insent and di kovenant box wey dem kova wit gold, dey der tu. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey insaid dis box.

5 God angels wey kova di place wer God dey show mesi and forgiv sins, dey on-top dis box. Bot dis nor bi di taim for mi to esplain all dis tins giv una.

6 Wen all dis tins don redi, di prists dey enta di first room evriday go du dia wok.

7 Bot na onli di High Prist dey enta di Holi Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, bifor e go offa for di pipol own, bikos dem nor no wetin dem sopoz to no.

8 Di Holi Spirit kon esplain sey, "Di way to rish di Holi Place neva opun as long as di old tent stil dey."

9 Dis na sign mak wi for fit undastand sey: Di gifts and sakrifais wey di prists dey offa for God pipol, nor fit mak dia maind klin.

10 To chop, drink and to du seremoni tak klin pesin bodi, na-im konsan dem. All dis won na rule for dis wold, ontil di taim wen God go bring di new law.

11 So Kraist don bi High Prist for di gud tins wey don kom. E don enta di Holi Place for hevun wey dey pafet. Nor bi humanbin mak di place and e nor dey among tins wey God kreate for dis wold.

12 Na wons Jisos enta di place wey holi pas. E nor enta wit goat or ram blood, bot na wit en own blood, so e don save us foreva and eva.

13 If goat or ram blood and ashes fit klin pesin akordin to di old tradishon,

14 wot of Kraist blood wey klin us from deat so dat wi go fit woship God? Dis na di Kraist wey offa ensef to God as di rite sakrifais for awa sins and e du-am wit di Holi Spirit pawa.

15 Na dis mak am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e kol go fit risiv di inheritance wey go dey foreva. E promis us dis inheritance, wen e die to fri us from di bad-bad tins wey wi don du, wen di first kovenant stil dey.

16 Dis kaind agriment bi laik pesin wil. Di pesin must die first, bifor dem go fit yuz di wil.

17 Bikos pesin wil nor dey min enitin wen e stil dey alaif; e onli dey yuzful wen di pesin don die.

18 Na dis mak di first kovenant nor get pawa to save pipol, unles dem sakrifais blood.

19 Wen Mosis read all di komands giv Izrel pipol, e tak goat and ram blood wit wota and soap, kon sprinkle di blood on-top di law book and all di pipol bodi, den e kon sey,

20 "Na dis bi di blood for di kovenant wey God komand sey una must obey."

21 Mosis stil sprinkle di blood for di tent and all di plate wey dem dey yuz tak woship God.

22 Tru-tru, akordin to di law, na almost evritin blood dey mak klin and if dem neva pour blood, God nor go forgiv dem dia sins.

23 Na dis mak dem dey klin di holi place for dis eart wit anima blood, bikos e bi laik di won for hevun. Bot di tins wey dey for hevun, nid sakrifais wey beta pas dat won.

24 Kraist nor enta di holi place wey humanbin build laik di origina tent for hevun, bot na hevun e enta and naw, e stand for God front for awa sake.

25 Kraist nor nid to offa ensef evri year laik di high prists dey du for di Tempol wit anima blood,

26 bikos if na so, Kraist for dey kom die for us evri year since di taim wey God kreate di wold. Bot nor bi so! E die wons and for all, so dat awa sins go-go foreva.

27 Bikos God tok sey, na onli wons man go die and afta dat, jojment go kom,

28 na so tu Kraist die wons, as sakrifais to forgiv pipol foreva and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.

Open Bible reader