Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 7

1 Melkizedek wey bi "Salem king" and "God prist", na-im bless Abraham, afta Abraham don win di kings for war.

2 So Abraham kon gi-am won from evri ten tin wey e bring kom bak from war. Melkizedek min, "King wey dey du wetin dey rite" and Salem min, "Peace."

3 E nor get papa or mama, e nor get stori at-all, en days nor get wer e for start or wer e go end, bot e bi laik Man Pikin and e bi prist foreva.

4 Bot si haw e big rish, bikos Abraham (awa gran papa wey evribodi no) gi-am won out of evri ten tins wey e bring from war.

5 Levi shildren wey bi prists, get pawa akordin to di law, to kolet won out of evri ten tins from dia own pipol, ivun doh di pipol demsef, na Abraham shildren tu.

6 Bot Melkizedek wey nor ivun relate to Levi pipol, stil kolet won out of evri ten tins from Abraham, den e kon bless Abraham wey God don promis.

7 Tru-tru, wi no sey pesin wey bless pesin, na-im big pas di pesin wey e bless.

8 Evri prists dey kolet won out of evri ten tins wey pipol bring, bot dem nor dey stay for di wold foreva, exept Melkizedek, bikos God wod tish us sey, e dey alaif.

9 Levi shildren dey kolet won out of evri ten tins from pipol, bot naw, wi go fit sey, wen Abraham giv won out of evri ten to Melkizedek, Levi pay tu,

10 bikos dat taim wen Abraham giv won out of evri ten tins wey e bring from war to Melkizedek, dem neva born Levi, bot Levi dey insaid am.

11 Ivun doh Mosis law sey prist must kom from Levi famili, dat kaind prist nor fit mak pesin dey pafet. So anoda prist laik Melkizedek must kom and e nor bi laik prist wey kom from Aaron famili.

12 Since dem don shange di rule to selet prist, di law must shange tu.

13 Di pesin wey wi dey tok abaut, na awa Oga wey kom from di tribe wer nobodi don eva serv as prist for alta bifor.

14 Evribodi no sey na from Juda tribe, Jisos from kom and Mosis law nor sey mak prist kom from dat tribe.

15 Dis mata klear wel-wel afta God selet anoda prist laik Melkizedek.

16 E nor selet dat pesin bikos of en gran-gran papa dem, bot na bikos en life nor go eva end.

17 God wod sey: "Yu bi prist foreva, jos as Melkizedek bi."

18 Bikos of dis, God put di old law for kona, since e dey wik and yuzles,

19 bikos di law nor fit mak enitin dey pafet. Bot naw, wi get beta hope wey go draw us near God.

20 God ensef mak promis wen E shuz dis prist, wey bi Jisos. E nor mak dis kaind promis wen E shuz di oda prists,

21 bot Jisos kon bi prist wen God sey, "I don swear and I nor go shange my maind sey yu go bi prist foreva."

22 Bikos God swear laik dis, Jisos don mak us dey sure of di new kovenant wey beta pas.

23 Meni prists don dey bifor and all of dem die,

24 bot Jisos nor go eva die. So, e go bi prist foreva.

25 So, di pipol wey Jisos tak go mit God, e go save dem for foreva and eva, bikos e dey alaif to pray for dem.

26 Na Jisos bi di High Prist wey wi nid. E nor dey du bad tin; e dey holi; nor dey mak mistak and e nor bi laik wi, wey bi sinas. God praiz am pas evritin wey dey hevun

27 and e beta pas eni oda high prists. Jisos nor nid to offa sakrifais evriday, laik di oda prists wey dey offa for dia own sins and for di pipol own. Bikos na wons and for all e sakrifais ensef for evribodi, wen e die for di kros.

28 Mosis law shuz humanbin wey get wiknes as High Prist, bot God promis wey kom afta di law, shuz di pikin and na-im bi di koret Prist foreva.

Open Bible reader