Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 4

1 Ivun doh God promis us res, e gud mak wi dey kareful, so dat som of us nor go miss di promis.

2 Bikos dem prish God wod giv us, jos as dem prish am giv dem tu. Bot dem nor tak am serious, bikos wen dem hear am, dem nor gri biliv am.

3 Na onli wi wey biliv go fit enta di place wer God res dey, bikos God sey, "I ves kon swear for dem, so 'Dem nor go eva enta my place wer res dey!'"

4 Wi no sey God redi and dey wait, bikos Bibol sey, "Afta God don kreate evritin finish, E kon res for di sevunt day."

5 E stil sey, "Dem nor go eva enta my place wer res dey!"

6 God promis sey wi go enta di place wer en res dey, yet doz wey first hear di mesage, nor enta, bikos dem disobey am.

7 Bot God don plan anoda taim wen wi go enta en res and dat taim, "Na today", bikos E don tok am for en wod bifor tru David.

8 Bikos if to sey Joshua giv dem res of maind, God for nor tok abaut anoda day.

9 So, di ril "Sabat Day" res, stil dey kom for God pipol.

10 Bikos pesin wey enta God res, don res from all en wok, jos as God res from en own wok tu.

11 So mak wi trai wel-wel, so dat wi go enta dat place wer res dey and non of us go fal laik di odas wey nor obey.

12 God wod dey alaif, e get pawa and e sharp pas knife wey get tu mout. Di wod dey divide pesin soul from en spirit and e dey divide bone from bone; bikos God no wetin wi dey tink for awa maind.

13 Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tel am haw wi liv awa life.

14 Jisos wey bi God Pikin, na-im bi awa High Prist wey don go hevun. Mak wi hol am tait and always dey biliv am.

15 Dis awa High Prist undastand us wen wi dey wik, bikos all dis temtashon wey wi dey face so, e face dem tu, bot e nor sin.

16 Mak wi nor fear to enta wer God throne dey: di place wer grace dey, so dat wi go get mesi and God grace go help us wen wi nid help.

Open Bible reader