Nigerian Pidgin Bible
Hebrews 10
1 Mosis law bi laik shadow wey dey show gud tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sikrifais wey dem dey offa evri year nor fit forgiv pipol dia sins.
2 If pipol wey dey woship God don fri from dia sins, dem nor for dey offa sakrifais again.
3 Doz sakrifais dey rimaind pipol of dia sins evri year,
4 since bull and goat blood nor fit rili klin pesin from all en sins.
5 So wen Kraist won kom dis wold, e tel God, "Nor bi sakrifais and ofrin Yu wont, bikos Yu don priper my bodi as ofrin,
6 since Yu nor laik anima blood as ofrin for sins again.
7 "Den I sey, 'Na mi bi dis, God na wetin Yu wont I kom du, jos as yor wod tok abaut mi for Mosis law.'"
8 Kraist first sey, "Yu nor wont anima or sin ofrin, (ivun wen dem dey offa am akordin to di law)".
9 Den e tok again sey, "Na mi bi dis, God na wetin Yu wont I kom du." So God rimov di first sakrifais, so dat E go fit bring di new won, wey bi Kraist.
10 Bikos Jisos du wetin God wont, all of us don dey holi tru di sakrifais wey e yuz en bodi mak for us.
11 Bifor-bifor, di prist dey serv evriday and dey offa di same sakrifais wey nor fit rimov sin.
12 Bot naw, Kraist offa onli won sakrifais for sin wons and for all, den e kon go sidan for God rite hand,
13 wer e dey wait ontil God go put en enemis unda en leg.
14 Na wit won sakrifais e tak klin pipol from dia sins and dem don dey klin foreva.
15 Di Holi Spirit dey bear witnes abaut dis tins sey,
16 "Dis na di kovenant wey I go mak wit una and afta dat taim,
17 e kon sey, 'I nor go rimemba dia sins and stubornes again.'"
18 Wen God don forgiv sins, e get eni nid to offa sakrifais again?
19 So my brodas and sistas, wi biliv sey wi go enta God Holi Tempol tru Jisos Kraist blood,
20 bikos e giv us dis new life and e go tak us pas di kurtain wey bi en bodi.
21 And wi get won High Prist wey dey kare for God Tempol.
22 So mak wi draw near God wit beta heart and strong fate, bikos God don wosh awa heart and bodi wit klin wota.
23 So mak wi hol di hope wey wi get strong wel-wel, bikos God wey promis us dey always kip en promis.
24 Mak wi always dey tink of haw wi go enkorage, luv and du gud for won anoda.
25 Mak wi nor stop to dey mit and feloship togeda, as som pipol dey du, bot mak wi enkorage won anoda more-more, since wi no sey, "Di Day wen Kraist go kom," don near.
26 If wi kontinu to sin afta God don show us di trut, e nor get eni oda sakrifais wey go fit forgiv us awa sins again.
27 Bot wetin wi go dey fear for na di Jojment Day wey dey kom and hell fire wey go distroi doz wey bi God enemis.
28 Wen tu or tiri pipol bi witnes sey sombodi rejet Mosis law, dem go kil-am witout sey dem sori for am.
29 If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey tak di kovenant blood mak yeye and dey kos di Spirit wey bring grace, na haw dia own ponishment go big rish?
30 Bikos God sey, "I go revenge, I go pay dem bak" and en wod stil sey, "God go joj en pipol."
31 Na big wahala if pesin fal enta God ponishment!
32 Bot mak una rimemba haw tins bi wit una bifor, haw una dey sofa afta una don risiv God lite, yet una nor alow di sofa shange una maind.
33 Dat taim, som pipol kos and sofa una and for oda taims, una dey help odas wey dey sofa laik una tu.
34 Tru-tru, una sofa laik oda prizinas and una dey hapi wen dem sieze all una propati, bikos una no sey una get beta tin wey go last foreva.
35 So mak una always dey strong, bikos una go get beta riwod.
36 Una nid to dey patient, so dat una go fit du wetin God wont and den, una go risiv en promis.
37 Bikos God wod sey: "E nor go tey again bifor di Pesin wey dey plan to kom, go kom.
38 "My raitious pipol go liv and biliv, bot if enibodi turn bak, I nor go dey hapi wit am."
39 Wi nor dey among pipol wey go turn bak kon perish, bot wi get fate wey go save us foreva.