Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Habakkuk 2

1 I go climb my watchtower and I go wait to see wetin God go tell me make I talk and the kind answer he go give to my complain.

2 Na the answer wey God give me be this: "Write down wetin I show you clearly, so that people go fit read am.

3 Write am down, because e never reach time wey e go happen. But the time dey come soon, and wetin I don show you go come to pass. E fit take time before e happen, but wait for am; e go surely happen and e no go tey.

4 And na the message be this: those wey be evil no go survive, but those wey dey righteous go live because dem dey faithful to God.""

5 "Wealth dey deceive. People wey get greed dey always proud and dem no dey get peace - like death wey no dey ever belleful, dem dey always want more and more. Na why dem dey always win nation upon nation for themselves be that.

6 And soon, all those people wey dem don conquer go laugh them and talk about their defeat. Dem go talk say, "Una take wetin no be una own, but una don enter trouble! How long una wan continue to dey rich by forcing una debtors make dem pay?

7 But before una know am, una wey don defeat others go con enter debt and dem go force una to pay interest. Enemies go shake una. Dem go rob una!

8 Una don rob people of many nation, and now the people wey remain go rob una because of the murder wey una don commit and because of una fight with people wey dey the world and the cities.

9 Una don enter trouble! Una don make una family rich with wetin una take by force and una dey try make una family dey safe from harm and danger!

10 But una plans don bring shame on top una family; as una destroy many nations, una don bring destruction on top unaself.

11 The stone of the wall go cry against una. Even the wooden rafter for una house go proof una wrong.

12 "See them! Dem kill people take build their city and do wicked thing take make their city wall strong.

13 Almighty God don talk say, fire go burn everything wey those people don work to build. And all their work go be for nothing.

14 Then people go know about the glory of God for everywhere. This news go spread like water dey spread for sea.

15 E go dey bad for una wey vex and make others suffer. Una make dem stagger like say dem don dey drunk.

16 Shame go catch una too instead of honor. Una go drink and stagger. God go make una drink una own cup of punishment and honor go turn disgrace for una.

17 Una hurt many people for Lebanon and steal many animals for there. Una go fear because of people wey die and because of bad thing wey una do the country. Una go fear because of wetin una do those cities and the people wey dey live for there."

18 Wetin be the use of idols? No be something wey human being make just to dey lie to una. E no do hin maker any good to trust am - god wey no fit talk.

19 Una don enter trouble! Una tell piece of wood say, "Wake up!" or tell block of stone say, "Get up!" Shey idol fit show una anything? Dem fit use silver or gold cover am, but e no get life.

20 God dey for him holy Temple; make everyone wey dey on top earth keep quiet for him presence.

Open Bible reader