Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 8
1 Six years after dem don take king Jehoiachin and rest of us as prisoner go Babylonia, the leaders of Judah con dey see me for my house, the Lord God suddenly come take control of me, on the fifth day of six month.
2 and I see something wey get shape of human. From waist go down, him body be like fire and from the waist go up he dey shine like bronze wey dem polish.
3 He stretch out something wey be like hand and use am hold my hair. In this vision the spirit of God carry me for sky and take me go Jerusalem. He take me go the inner entrance of north gate of the temple where idols wey dey vex God dey.
4 There I con see the light wey dey show presence of God of Israel, just as I don see am when I dey for River Chebar.
5 God tell me say, "Son of Man, look go north." I look, and for there near the alter by entrance of gateway, I see idols wey dey vex God.
6 God tell me say, "Son of man, you see wetin dey happen? See the rubbish things wey people of Israel dey do here, dem dey drive me commot from my holy place. You go even see terrible things wey pass this one."
7 He take me go the entrance of the courtyard and show me hole wey dey for wall.
8 He tell me say, "Son of man break through the wall for here." As I break am naso I see door.
9 He tell me say, "Go inside make you go see evil, and terrible things wey dem dey do for there."
10 Naso I go in and look. Na drawing of snake and others unclean animals dem use cover the walls, and dem also use drawing of other things wey Israelites dey worship.
11 Seventy Israel leaders dey there, with Jaazaniah son of Shaphan. Each one of dem dey hold incense burner and smoke dey come from the incense.
12 God ask me say, "Son of man, shey you see wetin Israel leaders dey do for secret? All of them dey worship for room wey plenty image dey. Dem dey give excuse say: God no dey see us! He don abandon the country.""
13 Then God tell me say, "You go even see them dey do things wey worse pass this one."
14 Naso he take me go north gate of the Temple and show me woman wey dey cry because god Tammuz don die.
15 He ask me say, "Son of man, say you see that? You go still see plenty things wey no make sense."
16 So he take me go the inner courtyard of the Temple. 25men dey near the entrance of the sanctuary, between the alter and the passage. Dem don turn their back against the sanctuary and dem bow down towards the east dey worship the rising sun.
17 God ask me say, "Son of man, shey you see that? These people of Judah never satisfy with terrible things wey you don see for here and with the way wey dem dey spread violence for the country. No, dem must come and do them here inside the holy Temple and make me dey vex more. See how dem insult me reach!
18 So I go punish dem in my anger without mercy and I go no go help dem when dem cry out to me."