Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 40

1 Twenty-five years after king Jehoiachin and rest of us don lead as prisoners go Babylonia, and 14 years after Babylonian don capture Jerusalem, power of God take control of me on tenth day of first month.

2 God show me some vision in which he carry me go top of high mountain for Jerusalem. I look the south and I see something wey look like city wey full of building.

3 God take me closer for my dream, and I see a man wey dey spark like polish bronze. He dey stand near one of gate and dey hold tape measure for one day and measuring stock for other hand.

4 The man talk say, "Ezekiel, son of man, pay close attention to everything wey I go show you-na reason why I bring you come here. Listen carefully because you must tell people of Israel wetin you see."

5 The first thing wey I see na outer wall wey surround temple area completely. That man take measuring stick, wey be three meter long, and he come measure the wall: the wall na three meter high and na three meter thick.

6 Then he come go east gate, where he walk go up step wey lead to long passageway. And three guardrooms dey for each side of this passageway wey be three meter square, and wall separate them wey be two and half meters thick. The man come measure the distance wey dey between opening of the gate and the first guardroom, and na three meter, wey be thickness of the wall.

7 At far end of this passageway, I come see entrance room wey face courtyard of temple. Dem also get three meter distance between last guardroom and entrance room

8 at end of passageway.

9 The man come measure this room: and na four meter E be from doorway go opposite wall, and distance from door way go end on other side na one meter.

10 Three guardrooms for each side of passageway na same size and wall wey separate them na same thickness.

11 Next thing be say, the man come measure width of the passage, and na six and half meters E be, but two doors of the gate na only five meter wide.

12 In front of guardroom, wey be three meter square, railing dey there wey be 50centimeter high and 50centimeter thick.

13 The man measure the distance from back wall one of this room go same spot for the room direct across passageway and e be twelve and half meter.

14 He come measure the entrance room from end of passageway and e be ten meter wide.

15 Finally, he come measure the total length of passageway, from outer wall go entrance room, and e be 25meters.

16 The three wall for the guardroom get small window inside am, just like the one wey dey entrance room. Dem use carving of palm tree decorate the wall along passageway.

17 The man come carry me pass the passageway and go outer courtyard wey dey the temple, where I come see 30rooms wey dem build round outside courtyard. Dem build this side room against outer wall and sidewalk for their front wey circle the courtyard.

18 Dem dey call this lower sidewalk, and e be 25meter wide.

19 I come see the gate way go inner courtyard of the temple and I notice say dem high pass those wey dey go outer courtyard. The man come measure the distance wey dey between outer and inner gate, and e be 50meters.

20 Next, the man measure north gate wey go outer courtyard.

21 This gate too get three guardroom for each side of passageway. The measurement of these rooms, the wall wey dey between them, and the entrance room for far end of passageway na exactly the same as those wey dey east gate. The north gate too na 25meters long and 12.5 meter wide,

22 The windows, the entrance room, carving of palm tree be like those of east gate. The entrance room too face the courtyard of the temple and e get seven set wey dey go up to am.

23 A gate dey wey lead to inner courtyard, wey dey directly across the outer courtyard, just as e dey for east gate. The man come measure the distance between outer and inner gate and e be 50meters.

24 The man come carry me go south gate. He come measure the wall and entrance room of this gate, and the measurement na the same with those two gate.

25 Windows dey guardroom of this gate and dey for entrance room, just like others and this gate na 25 meter long and 12.5 wide.

26 Na seven step lead up go gate, the entrance room dey far end of passageway and dey face courtyard of the temple. Dem carve palm tree take decorate wall of along the passageway.

27 Gate dey the south side of the inner courtyard wey dey directly across outer courtyard. The man come measure the distance wey dey between inner and outer gate, and the distance na 50meters.

28 We come go inner courtyard through gate wey dey south side for the temple. The man come measure the gate and na the same size e be with gate wey dey outer wall.

29 In fact everything wey dey along passageway na same size, with guardroom, the wall wey dey separate them, the entrance room for the far end, and windows.

30 This gate na like others, na 25meter long and 12.5 meter wide.

31 Entrance room of this gate come face outer courtyard, dem carve palm tree take decorate wall of passageway. Na eight step go lead go up this gate.

32 Next, we commot go inner courtyard through east gate. The man come measure this gate, and na the same size as others.

33 The guardroom, the wall dey separate them, and entrance room na same measurement with other gate. The guardroom and entrance room get window, and the gate na 25meter long and 12.5 meter wide.

34 The entrance room dey Face outer courtyard, and dem decorate the wall for passageway with carving of palm tree. Na eight steps lead go up this gate.

35 Then, the man carry me go north gate. He come measure am, and na same size with others,

36 Including guard room, the wall wey dey separate them, and entrance room. Window too dey this gate. E be 25meters long and 12.5 meter wide,

37 And like other inner gate, the entrance room dey face outer courtyard, and dem decorate hin wall with carving of palm tree. Na eight steps also lead up go this gate.

38 I see four table, and two dey each side of the room, where dem dey kill animal wey dem wan use do sacrifice for inside entrance room of north gate

39 Small building dey inside this room wey dem dey use to dey wash the animal before dem offer dem as sacrifice so e fit please God or sacrifice for sin oe to make things right.

40 Four more table dey for the courtyard, two dey each side of the step wey dey lead go entrance room.

41 So na 8 tables dey there together, four for inside and four for outside, where dem dey kill the animals,

42 And where dem dey put the meat until dem sacrifice am for alter.

43 Four stone table 50centimeter high and 75 centimetre square dey next to table wey dey the entrance room: na equipment wey dem dey use kill the animals dem dey keep for on top the table. All around the wall of this room na 75-milimeter shelf.

44 The man take me again go inner courtyard, where I come see two buildings, one dey beside inner gate for north and other one dey beside inner gate for south.

45 He talk say, "The building wey dey beside north gate belong to priest wey serve for temple,

46 And the building wey dey beside south gate belong to those wey serve for alter. All of them na descendant of Zadok and only Levites wey dem allow to dey serve as priest of God. "

47 Now the man come measure the inner courtyard, and na 50 meter square e be. Me too see alter in front of temple.

48 We walk go porch of the temple, and the man measure doorway of the porch: e be seven mete long, two and half meters wide, and distance from doorway to wall on either side na one and half meters.

49 The porch size na six meter, with steps wey dey lead down to it. Columns dey each side of these step.

Open Bible reader