Nigerian Pidgin Bible
Exodus 10
1 God tell Moses say, "Go meet Pharaoh make you tell him wetin you want again. I don make him and him servant stubborn again, so that I go fit show them my power.
2 And I don do this thing so that you go fit tell your pikin and pikin wey your pikin born how I take use Egyptian crack joke and the miracle wey I dey do for their front " so you go know say I be God.
3 Naso Moses and Aaron go meet Pharaoh and dem tell him say, "Na wetin the LORD, God of Hebrew talk be this: How long you wan dey do strong head for me? Allow my people go, so dem fit worship me.
4 If you no gree, just dey watch! I go send plenty Locust inside your country tomorrow.
5 Dem go cover ground, and you no go fit see ground. Dem go destroy all the food wey remain after storm, dem go even destroy all tree wey dey your farm.
6 Dem go cover your palace, your servant house, and all house wey dey for Egypt.
7 Pharaoh servant come beg Pharaoh. "How long u go allow this man take us like hostage? Allow the men make dem go worship their God. You no notice say Egypt don dey perish?
8 Naso dem bring Moses and Aaron back to Pharaoh. He say, "All right, make una go worship una God. But who and who go follow you go?"
9 Moses answer him say, "Na all of us: old and young, sons and daughters, and our animals. All of dem go join go celebrate festival to God.
10 The king say, "I take God swear, I no go allow una go with una woman and pikin. E dey clear now say una get evil plan.
11 Never! Na only men fit go worship God, since na wetin you ask be that." Naso Pharaoh chase them commot for palace.
12 God come tell Moses say, "Raise your hand on top Egypt make locust come. Make dem cover land and chop every plant wey remain after storm.
13 Naso Moses raise him walking stick, God come command wind from east make e blow on top the land for that day and night. The wind don bring locusts by morning.
14 Locusts don spread over Egypt land, and dem settle for everywhere, for every corner. Na the worst locust curse for Egypt history be this, and nobody see that kind plenty locust again.
15 The locust cover the whole country and the land dey very dark. Dem chop off all plant wey dey farm and fruits wey storm no destroy. No leaf remain for trees and plants wey dey Egypt.
16 Pharaoh quickly call Moses and Aaron. He begin dey confess say, "I don sin against God and you.
17 Make una forgive my sin for once, and help me beg your God make e take away death from me."
18 Naso Moses leave Pharaoh side and he beg God.
19 God come answer him, he shift wind go west wey come blow the locust enter Red Sea.
20 Na so God make Pharaoh heart hard again, and he no allow the people go.
21 God come tell Moses say, "Raise your hand toward sky, and thick darkness go cover Egypt land."
22 Moses come raise him hand toward sky, and darkness come cover Egypt for three days.
23 For that time Egyptians no fit see themselves, and dem no commot for house. But Israelites get light for where dem dey live.
24 Pharaoh come call Moses and say, "Una fit go worship God; even una women and children fit go too. But una goats, sheeps, and cattles must stay.
25 Moses come answer say, "You go need to provide animals wey we go use for sacrifice and burnt offering to God.
26 No, we go take our animals with us; we no go leave anyone. We go need select which animal we wan use worship God. And we no fit know which animal we go use until we reach there.
27 God come make Pharaoh stubborn and he no allow them go.
28 He tell Moses say, "Commot for my sight! I no wan see you again! The day I see you, you go die.
29 Moses come answer him say, "Na true you talk. You no go ever see me again"