Nigerian Pidgin Bible
Ephesians 5
1 So, mak una dey bihav laik shildren wey God luv wel-wel.
2 Mak wi luv won anoda, jos as Kraist luv and sakrifais ensef as ofrin wey get beta smel to God, bikos of us.
3 To dey slip wit pesin wey yu nor mari; dey du tins wey nor dey pure and get long-trot; mak una nor alow dis tins dey among una, bikos dem nor gud for God pipol.
4 Mak una nor alow yeye and foolish wod kom out from una mout. And mak una nor dey tok enihaw or yuz bad wod, bikos all dis tins nor gud. Insted, mak una dey tank God wit una mout.
5 Won tin wey una must no bi sey, pesin wey dey slip wit hu e nor mari, wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serv juju, nor go enta Kraist and God kindom.
6 Mak una nor let enibodi disiv una wit yeye wod, na dis tins mak God dey ves for doz wey nor dey obey am.
7 So mak una nor join dem.
8 Bifor-bifor, una dey for daknes, bot naw, una bi lite wey dey shine insaid Kraist. So mak una dey du tins laik shildren wey get lite,
9 bikos di frut wey lite get, dey bring gudnes, raitiousnes and trut.
10 So, mak una always dey du tins wey go mak God hapi.
11 Mak una nor put hand for bad tins, insted, mak una dey expoz dem.
12 Shame nor go let wiked pipol tok abaut wetin dem dey du for sikrit.
13 Bot evribodi go si evritin wey kom out for lite.
14 Bikos na lite dey mak evritin shine kom out and na dis mak dem rite sey: "Wak-up; yu wey dey slip! Mak yu raiz from grave and Kraist go shine for yor life!"
15 Mak una dey kareful as una dey liv una life. Mak una nor bi laik pipol wey nor get sense.
16 Mak una yuz evri shanse wey una get wel, bikos dis taim wey wi dey so, dey evil and wiked.
17 Bikos of dis, mak una get sense to undastand wetin awa Oga wod tok and min.
18 Mak una nor dey drink strong drink, bikos e go distroi una. Bot mak una alow God Spirit fil una maind.
19 Mak una dey tok to unasef wit psalms, hymns and spiritual songs. For insaid una heart, mak una dey praiz God wit hymns and psalms.
20 Wit awa Oga Jisos Kraist name, mak una dey tank God awa papa for ish oda.
21 Bikos of di respet wey una get for Kraist, mak una dey respet won anoda.
22 Una wey bi wife, mak una dey respet una husban, jos as una dey respet Kraist,
23 bikos na di husban bi di wife head, jos as Kraist bi head for di shosh and naim en save di bodi.
24 As di shosh dey sumit to Kraist, na so tu, wife sopoz sumit to dia husban for evritin.
25 Husban, mak una luv una wife, jos as Kraist luv di shosh kon sakrifais en life for am,
26 so dat e go fit mak am klin, tru baptism and God wod.
27 E du laik dis, so dat di shosh go bi laik wife wey fine wel-wel, wey nor get eni stain, dey du enihaw or get eni oda tin wey fit spoil am.
28 Na so tu, husbans sopoz luv dia wife laik dia own bodi. Man wey luv en wife, luv ensef.
29 Nobodi don eva hate e own bodi, bot e dey fid and kare for am, jos as Kraist dey kare for di shosh,
30 bikos wi bi part for en bodi.
31 Na bikos of dis, man go liv en papa and mama go join en wife and di tu of dem, go bi won flesh.
32 Dis sikrit wey I dey tel una so big wel-wel, bot na di tin wey dey bitwin Kraist and di shosh, I dey tok abaut.
33 So, ish man sopoz luv en own wife, jos as e luv ensef and evri wife sopoz respet en husban.