Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Deuteronomy 4

1 Moses tell the people say, "Israel, make una listen to these laws and teachings! If una obey them, una go live, and una go enter and take the land wey God dey give una. He be the God una ancestors worship,

2 and now he be una God. I tell una everything wey he don command.

3 Una see how he kill every person wey worship the god Baal Peor.

4 But all of una wey dey faithful to the LORD una God still dey alive today.

5-

8 No other nation get laws wey dey good like the ones wey the Lord my God tell me make I give una. If una obey them when una enter the land, una go show other nations as una wise reach. In fact, everyone wey hear of una laws go say, "That great nation wise!" And wetin make us great pass other nations? We get a God wey dey close to us and dey answer our prayers.

9 Make una dey very careful and no forget the things una don see God do for una. Make una dey remind unaself, and make una also tell una children and grandchildren too.

10 Shey una remember the day una stand for God presence for Mount Sinai? God say, "Moses, bring the people of Israel come here. I wan follow them talk so that dem go obey me as long as dem live, and so dem go teach their children make dem obey me too."

11 Deep cloud surround Mount Sinai, and fire go up to sky. Una come to foot of the mountain,

12 and God speak to una from the fire. Una fit hear him and understand wetin he dey say, but una no see him.

13 God talk say he dey make agreement with una, and he tell una say una part of the agreement na to obey the Ten Commandment on top two flat stones.

14 Na that be when God command me make I give una the laws and teachings una must obey for the land wey una go defeat for west of Jordan River.

15 When God speak to una from fire on top Mount Sinai, una no see him. So, make una dey careful

16 make una no commit sin of worshipping idols. No make idols wey una go dey worship, whether e get shape like man, woman,

17 wey look like animal, birds,

18 wey look like reptiles, or fish.

19 And when una see the sun, moon, or star, make una no try bow down and worship them. God put them there for other nations to dey worship.

20 But na God people una be, because he rescue una from Egypt, that terrible fire.

21 God dey vex with me because of wetin una say, and he tell me say he no go allow me cross Jordan River enter the good land wey he dey give una.

22 So, I must stay here and die for this side of Jordan, but una go cross the river and take the land.

23 Make una dey always remember the agreement wey the LORD una God make with una, and make una no make idol in any shape or form.

24 God go vex if una worship other gods, and he fit be like fire wey dey destroy everything wey come him way.

25-

26 Soon una go cross Jordan River and settle down in the land. The years to come, una go get children, and dem go give una grandchildren. After many years, una fit loose sense of wetin dey right and wrong and make idols, even though the LORD una God hate them. So, I dey give una warming today, and I call earth and heaven as witnesses. If una make idols, God go vex, and una no go dey live long, because God go allow make dem wipe out una.

27 Na only few of una go survive, and God go force una to leave the land and scatter una among other nations.

28 For there, una go dey worship idols wey dem make with wood and stone, and dem be nothing but idols wey no fit see or hear or eat or smell.

29-

30 For all una troubles, una fit decide say una wan worship only the LORD. And if una turn back and obey him fully, he go be una God again.

31 The LORD una God go get mercy " he no go destroy una or leave una. God go remember him promise, and he go keep the agreement he make with una ancestors.

32-

34 When the LORD una God bring una out of Egypt, una see how he fight for una and show him great power as he perform miracles. Una become him people, and for Mount Sinai una hear him dey talk to una from fire. And yet una still dey alive. Shey anything like this don ever happen since God make human? No matter where una go or who una ask, una go get same answer. No one don ever hear of another god try do that kind things wey the LORD una God don do for una.

35-

36 God wan make una know say na him be the only true God, and he wan make una obey him. That na why he allow una see him mighty miracles, and him terrible fire on earth, and why una hear him voice from that fire and from sky.

37 God love una ancestors and decide say una go be him people. Naso God use him great power to bring una out of Egypt.

38 Now una dey face other nations wey dey powerful pass una, but God don already start to dey force them out of their land and dey give am to una.

39 Make una remember say the LORD Na the only true God, whether for heaven or for earth.

40 Today I dey explain him laws and teachings. And if una always obey them, una and una descendants go live long and dey successful for the land God dey give una.

41-

43 People of Israel, una must set aside the three towns wey follow for east of Jordan River as Safe Towns: Bezer for desert highlands wey belong to Reuben tribe; Ramoth of Gilead, wey belong to Gad tribe; and Golan in Bashan, wey belong to Manasseh tribe. If una kill a neighbor by mistake, and una no get fight with the person before, una fit run to one of these towns and find safety.

44-

46 The Israelites don come from Egypt and dem camp east of Jordan River near Beth-Peor, when Moses give the laws and teachings. The land wey dey around their camp don belong to King Sihon of Heshbon before. But Moses and Israelites defeat him

47 and King Og of Bashan, and take their lands. These two Amorite kings don rule the territory for west of Jordan River

48 from town of Aroer near edge of Arnon River, north of Mount Hermon.

49 Their land na eastern side of Jordan River valley, take reach Dead Sea, below slopes of Mount Pisgah.

Open Bible reader