Nigerian Pidgin Bible
Deuteronomy 23
1 If a man private part don spoil or cut off, he no fit join people of Israel to worship the LORD.
2 If a man parent no marry legally, that man no fit join men of Israel to worship the LORD. And none of him descendants, take reach tenth generation " go fit join that group.
3 Ammonite or Moabite no fit join men of Israel when dem gather to worship the LORD. And their descendants, take reach tenth generation, no fit join for worship of the LORD.
4 Na because when una come out of Egypt, dem no gree give una food and water. And dem even hire Balaam make he come put course on una.
5 But the LORD una God love una, so he no hear wetin Balaam talk and he turn Balaam curse to blessing.
6 Make una no even think say una wan make peace with Moabites and Ammonites.
7 But Edomites na una relatives, and una don live as foreigner for Egypt country. Now, una must dey good to Edomites and Egyptians
8 and make una allow their great-grandchildren be part of Israel, God people.
9 When una men go fight una enemies, make una stay away from things wey go make una unclean.
10 For example, if something happen for night wey make a man unclean for worship, make he go outside camp and stay there
11 until evening. Then make he bath, and when sun don go down he fit go back to the camp.
12 Make una set up a place outside camp wey una go dey use as toilet area.
13 And make una dey sure say una get small shovel as part of una equipment. When una go out to the toilet area, make una use the shovel dig hole. Then after una don shit finish, make una bury the shit for the hole.
14 Make una keep una camp holy. Because God always dey for una camp to rescue una and help una defeat una enemies. But if he see something wey no holy for una camp, he fit turn back and leave.
15 When slave wey dey run away from other country come Israel and ask for protection, make una no give them back to their owners.
16 Instead, make una allow them choose one of una town wey dem wan dey live. Make una no treat runaway slave bad.
17 People of Israel, make any of una no turn temple prostitute.
18 The LORD una God no like men or women wey be any kind prostitute, he no go accept their gift, even if dem don promise him before.
19 When una borrow other Israelites money, food, or anything else, make una no put interest.
20 Una fit put interest on foreigner own. But if una put interest for other Israelites, the LORD una God no go let una dey successful for the land wey una wan take.
21 People of Israel, if una make a promise to give a gift to the LORD, make una no delay to pay una promise. If God come begin dey look for the gift wey una promise, una go dey guilty say una break that promise.
22 But if una no make promise to the LORD, una no fit dey guilty.
23 Una must keep any kind promise wey una make to God. Shebi na una decide to make promise.
24 If una enter vineyard wey be another person own, una fit eat the grape as una like when una dey there. But make una no take any of am as una dey leave.
25 For same way, if una dey grain field wey be another person own, una fit pick grain and eat am. But make una no cut down the grain tree or carry am go.