Nigerian Pidgin Bible
Colossians 4
1 Una wey bi masta, mak una trit una savants wel and nor shit dem, bikos una no sey, unasef get masta for hevun.
2 Mak una dey serious for una praya. Mak una dey shine una eye as una dey tank God wen una dey pray.
3 Laik dis tu, mak una dey pray for us, so dat God go giv us beta shanse to tok abaut Kraist sikrit, wey I dey prish abaut.
4 Mak una pray mak I tok wel, so dat pipol go undastand mi.
5 Mak una dey wise as una dey tok wit pipol wey nor dey folo Kraist. Mak una yuz evri shanse wey una get wel.
6 Mak all of una wod dey gud and swit laik wetin dem put sugar, so dat una go no haw to ansa evribodi.
7 Tikikus, my broda wey I luv and awa Oga savant; wey dey wok wel-wel laik mi, go tel una evritin wey dey hapun to mi.
8 Na bikos of dis I send am kom mit una, so dat una go no haw tins bi for us and mak e for giv una heart.
9 Onesimus, di broda wey dey wit us, wey wi luv wel-wel, wey bi won of una, I dey send am folo Tikikus. Dem go tel una evritin wey dey hapun for here.
10 Aristakus, wey folo mi dey prizin dey grit una and Mark wey bi Banabas kozin (wey wi bin tel una sey, if e kom mit una, mak una welkom am) dey grit una tu.
11 Jisos wey dem stil dey kol Justus, dey grit una. Ju pipol wey bi Kristen and dey folo mi du God wok, na onli dem dey help mi.
12 Epafras, wey bi won of una and Kraist savant, dey grit una. E dey pray wel-wel for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.
13 Bikos I bi witnes sey, e don wok wel-wel for una and doz wey dey Laodisia and Hierapolis.
14 Awa frend Luke, wey wi luv wel-wel, wey bi doktor and Demas, dey grit una tu.
15 Mak una tel di brodas and sistas wey dey Laodisia, wit Nimfa and di shosh wey dey gada for en haus sey, I grit dem.
16 And afta una don read dis leta, mak una let di shosh wey dey Laodisia read am tu. Den mak una stil read di leta wey I rite giv dem.
17 Mak una tel Arkipus sey, mak e finish di wok wey Kraist gi-am.
18 Mi Pol, dey rite dis gritin wit my own hand. Mak una rimemba di chains wey dem tak tie mi and mak God grace dey wit una.