Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Colossians 2

1 Pipol for Laodisia and doz wey neva si mi face to face, I wont mak una no haw I dey wok for una rish.

2 Wetin I wont bi sey, wen una don rili undastand God sikrit wey dey insaid Jisos Kraist, mak una heart dey strong wit luv, so dat una go get evritin wey una wont.

3 Bikos all di wisdom and knowledge wey God get, E hide dem insaid Kraist.

4 I dey tok all dis tins, so dat nobodi go dey disiv una wit argument.

5 And ivun if I nor dey der wit una, my spirit dey der and I dey hapi sey una maind nor dey shange and una fate for Kraist, stil strong wel-wel.

6 So, jos as una asept Jisos Kraist as una Oga, mak una kontinu to liv una life insaid am.

7 Mak una dey strong for groun and dey grow insaid Kraist, so dat una fate go strong as wi dey tish una and una go dey tank God wel-wel.

8 Mak una tak kare and nor let enibodi fool una wit wayo tok abaut humanbin wisdom and spiritual pawas wey dey rule di wold, bot mak una dey du as Kraist wont.

9 Bikos na Kraist dey show us evritin abaut God.

10 And una dey komplit insaid am; bikos na-im bi di head for all di pawas wey dey for hevun and eart.

11 Dem sekonsaiz una insaid am. Dis nor bi humanbin sekonsishon, bot na di spirit own, wey Kraist dey du.

12 Bikos wen dem baptaiz una, dem bere una wit am and una folo am raiz-up tru di fate wey God pawa dey giv and na dis God raiz-am up.

13 And ivun doh una bin don die insaid una sin bikos dem nor sekonsaiz una bodi, God kon mak una dey alaif wit am, bikos E don forgiv una sins.

14 E don distroi doz bad-bad tins wey una dey du and wetin dem rite abaut awa debt wey fit kil us, God rimov am kon nail dem for di kros.

15 God disgrace wiked and evil rulas for publik, wen E win dem for di kros.

16 So mak una nor let enibodi tak fud, drink, parti, new moon or Sabat mata, tak joj una.

17 Bikos all dis tins na shadow for di tins wey go kom, bot di ril tin, na Kraist!

18 Mak una nor let doz wey dey pritend and woship angels joj una. Dat kaind pesin dey tok enihaw abaut vishon wey e sey e si, bot na yeye tins and sin ful en maind.

19 Dat pesin nor dey wit Kraist wey bi di head. Bikos na Kraist join di hol bodi togeda, as dem dey grow insaid God.

20 Since una don die wit Kraist and e don fri una from wiked pipol, den why una stil dey bihav as pipol wey nor no God?

21 Wen dem sey, mak pipol nor hol, chop or tosh som tins, e nor min enitin.

22 All dis tins dey yuzles as pipol dey yuz dem, bikos na humanbin mak all dis rules.

23 E bi laik sey dis tins get wisdom, bikos pipol dey woship angels, dey pritend sey dem gud and dey sofa dia bodi; bot dis wisdom nor get value, bikos e nor fit stop pesin mak e nor du di yeye tins wey dey en maind.

Open Bible reader