Nigerian Pidgin Bible
Amos 2
1 God talk say; "I go certainly punish the people of Moab for many crime wey dem don do. Moab don disrespect the bones of king of Edom so tey dem burn am.
2 Na so I go start fire for Moab wey go destroy the high towers of Kerioth. Terrible shout and sounds of trumpet go dey, and Moab go die.
3 God talk say, I go bring end to the king of Moab, and I go kill every leader for Moab."
4 God talk say "I go certainly punish Judah for many crime wey dem don commit. Dem no dey obey the law of God and dem no keep him commands. Their ancestors believe lie and the lie no allow people of Judah dey follow God.
5 So I go start fire for Judah wey go destroy the high tower for Jerusalem."
6 Na wetin God talk be this; The people of Israel don sin again and again, and na why I go certainly punish dem. Dem sell honest people wey no fit pay their debt go slavery, dem sell poor people for price of sandals.
7 Dem match down the weak and helpless, push the poor comot for road. One man and him father have sex with the same slave woman, dem destroy my holy name.
8 For every place of worship people siddon on cloth wey dem collect from poor people wey no fit pay their debts. For temple of their God dem drink wine wey dem collect from people wey dey owe them money.
9 "And yet na for una sake my people, I destroy the Amorite, wey tall like cedar trees and strong like Oaks.
10 I carry una comot for Egypt, lead una for desert for forty years, and give una the land of Amorites make e be una own.
11 I choose some of una son make dem be prophets, and some of una young men make dem be Nazirites. People of Israel, no be so? I, the LORD don speak.
12 But una make the Nazirites drink wine and una no allow the prophets speak my message.
13 Now I go crush una go down, and una go be like wagon wey corn full am.
14 Even person wey dey run fast no fit escape, strong men go lose their strength, and soldier no go fit save their own lives.
15 Bowmen no go stand their ground, person wey dey run fast no go fit escape, and men wey dey horses no fit escape alive.
16 Na wetin God don talk be this, "for that day even the soldier wey brave pass go drop their weapon and run."