Nigerian Pidgin Bible
Acts 9
1 As all dis tins dey hapun, Sol stil dey tel di disaipols sey e go kil dem. E go mit di High Prist
2 kon tak pamishon to tak go Damaskus, so dat if e si enibodi wey dey folo Jisos Kraist wey bi di Way, weda na man or wuman, e go arres dem kom Jerusalem.
3 As e dey go, won lite from hevun kon shine roun wer e dey.
4 E fal for groun kon hear won vois wey kol en name, "Sol, Sol, wetin mak yu dey ponish mi?"
5 So e ansa, "Oga, na hu dey tok so?" Di vois ansa am, "I bi Jisos Kraist wey yu dey ponish!
6 "Naw, mak yu get up go insaid di tawn and dem go tel yu wetin yu go du."
7 Di men wey dey folo am travol, sopraiz dey luk, bikos dem hear vois dey tok, bot dem nor si enibodi.
8 So Sol get up from groun, en eye opun, bot e nor dey si. En frends hol en hand kon eskot am enta Damaskus.
9 E nor si at-all for tiri days and for dat taim, e nor chop or drink enitin.
10 Dat taim, e get won disaipol for Damaskus and en name na Ananias. God kol am for insaid vishon, "Ananias", e kon ansa, "Na mi bi dis, Oga."
11 God kon tel am, "Get-up mak yu go di strit wey dem dey kol 'Strate' and wen yu rish Judas haus wey dey der, mak yu luk for won man, en name na Sol and e kom from Tarsus. You go mit am dey pray for der.
12 "I don show am for vishon sey won man wey dem dey kol Ananias go kom mit am and e go put hand for en head, pray for am, mak e for fit si again."
13 Bot Ananias ansa, "Oga, meni pipol don tel mi abaut dis man and all di wiked tins wey e don du to yor pipol for Jerusalem.
14 "E ivun kolet leta from di prist oga dem, wey e go tak kash and trow pipol wey biliv yu, for prizin."
15 Bot God tel Ananias, "Mak yu go mit am, bikos I don shuz am mak e kari my name to Gentai pipol, kings and all Izrel pipol.
16 "Tru-tru I go show am haw e go sofa, bikos of my name."
17 So Ananias go di haus and wen e enta, e put en hand for Sol head kon sey, "Broda Sol, di Oga wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here, na en send mi kom mit yu, so dat yu go fit si again kon risiv di Holi Spirit."
18 At wons, somtin wey bi laik fish scale fal komot from Sol eye and e kon dey si. E get up and dem kon baptaiz am.
19 Afta e chop finish, en bodi kon strong again.
20 At wons, e kon start to dey prish for di sinagog sey Jisos Kraist na God Pikin.
21 Evribodi wey hear am kon dey sopraiz dey ask demsef sey, "Dis nor bi di man wey dey kil pipol wey biliv Jisos Kraist? Wi tink sey e kom here kon arres pipol kari go giv di prist oga dem."
22 Bot Sol stil dey prish wit pawa. E dey show sey na Jisos Kraist bi di Mezaya and di Ju pipol wey dey for Damaskus, nor fit ansa am.
23 Afta som days, di Ju pipol kon dey plan to kil-am,
24 bot Sol hear wetin dem dey plan. Som pipol dey wosh for di tawn gate day and nite mak dem for fit kil-am wen dem si-am.
25 Bot won nite, di pipol wey dey folo Sol kon put am for basket, drop am dan smol-smol from won smol window wey dey near di tawn fence.
26 Wen e rish Jerusalem, e kon trai to join di disaipols, bot dem dey fear am, bikos dem nor biliv sey e don bi Jisos Kraist disaipol.
27 So Banabas tak Sol go mit di apostols, den e tel dem haw Sol tak si Jisos Kraist for vishon wen e dey go Damaskus and haw e bigin dey prish wit boldnes abaut Jisos Kraist.
28 Sol stay and waka wit dem for Jerusalem and e dey tok wit boldnes abaut Jisos Kraist.
29 E bigin dey tok and argue wit di Ju pipol wey dey speak Greek, bot som pipol kon dey trai to kil-am.
30 Wen di brodas no abaut wetin dem dey plan, dem kon tak am go Sizeria and from der, dem send am go Tarsus.
31 Dat taim, di shosh wey dey Judea, Galili and Samaria get res and dis kon mak dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God wit all dia heart and as di Holi Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di shosh kon dey plenti more-more.
32 Pita dey travol from won place go anoda and e stil go wer di bilivas dey for Lydda.
33 E kon mit won man for der, en name na Aeneas wey nor fit waka since wen e bi ate years.
34 Pita kon tel am, "Aeneas, Jisos Kraist, wey bi di Mezaya, won heal yu naw. So mak yu stand-up, kari yor bed!" At wons, e get up kon kari en bed.
35 All di pipol wey dey Lydda and Sharon si wetin hapun and dem kon bigin folo Jisos Kraist.
36 Won wuman dey for Jopa wey bi Jisos Kraist disaipol and en name na Tabita (wey min Dorkas for Greek language). E dey du gud tins and dey help poor pipol.
37 E sik and e kon die. Wen di pipol don wosh en dead bodi, dem kon kari am put for won room for upstair.
38 Bikos Lydda dey near Jopa, so wen di disaipols hear sey Pita dey der, dem kon send tu men go kol am sey, "Mak yu kom mit us at wons."
39 So Pita get up folo dem and wen e rish der, dem kon tak am go di room for up. All di wimen wey dia husban don die stand near Pita dey krai and dey show am all di dress wey Dorkas mak for dem, wen e dey wit dem.
40 Bot Pita driv all of dem go outsaid, den e nil dan kon pray. E turn face di dead bodi kon sey, "Tabita, get up!" Naim di wuman opun en eye and wen e si Pita, e kon sidan.
41 Pita kon hol en hand stand-up. Den e kol di bilivas and all di wimen wey dia husban don die and e kon giv di wuman to dem.
42 Wen evribodi for Jopa hear dis tin wey hapun, meni of dem kon biliv Jisos Kraist.
43 Pita kon stay for Jopa for meni days wit won man wey dem dey kol Saimon, wey dey du leatha wok.