Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 8

1 Sol hapi wen dem dey kil Steven. Na from dat day trobol start for di shosh wey dey Jerusalem and all di bilivas kon skata go Judea and Samaria, bot na onli di apostols nor run.

2 Som men wey dey holi, kari Steven go bere, afta dem don mourn am.

3 Bot Sol trai to distroi di shosh; e dey go from haus to haus dey arres men and wimen put for prizin.

4 So di pipol wey skata kon dey go from place to place dey prish di gospol.

5 Filip travol go Samaria main tawn kon dey prish abaut di Mezaya giv dem.

6 Di pipol wey gada, put dia maind for wetin Filip dey tok, bikos dem don hear and si all di mirakols wey e du.

7 Wiked spirit dey shaut and dey komot from pipol bodi as dem hear God wod and God heal meni pipol wey nor fit waka.

8 So all di pipol wey dey di tawn kon dey hapi wel-wel, bikos of wetin dey hapun.

9 E get won strong man for di tawn wey dem dey kol Saimon and e dey du magic wey dey mak Samaria pipol sopraiz.

10 Evribodi, both smol pikin and big pipol, dey biliv wetin e dey du and dem biliv sey, "Na God gi-am pawa!"

11 Dem dey listin to am bikos, e don tey wen e dey yuz magic tak dey du wondas.

12 Bot wen dem biliv di Gud News wey Filip prish abaut God Kindom and abaut Jisos Kraist, dem kon baptaiz di pipol wey biliv.

13 Ivun Saimon sef biliv and afta dem don baptaiz am, e kon dey waka wit Filip, bikos all di mirakols wey God dey du tru Filip, dey sopraiz am.

14 Wen di apostols wey dey Jerusalem hear sey Samaria pipol don risiv God wod, dem kon send Pita and Jon go mit dem,

15 so dat dem go pray for di pipol, mak dem for risiv di Holi Spirit.

16 Bikos for dat taim, dem neva risiv di Holi Spirit. Na onli Jisos name dem tak baptaiz dem.

17 Pita and Jon put hand for di pipol head and dem kon risiv di Holi Spirit.

18 Wen Saimon si sey pipol dey risiv di Holi Spirit as di apostols put hand for dia head, e kon giv di apostols moni

19 kon sey, "Abeg, mak una giv mi dis pawa mak I for fit put my hand for pipol head mak dem for risiv di Holi Spirit tu."

20 Bot Pita ansa am, "Mak yu and yor moni go die! Yu tink sey yu fit buy God gift wit moni?

21 "Yu nor get share for insaid dis tin wey God dey giv, bikos God don si sey na bad tin yu won tak am du.

22 "So mak yu turn from sin kom mit God and from di bad tins wey dey yor maind and pray mak God forgiv yu.

23 "Bikos I si sey na long-trot and bad bele dey wori yu and sin stil ful yor maind."

24 Saimon kon ansa, "Mak yu pray to God for mi, so dat di tin wey yu tok so, nor go hapun to mi."

25 Afta Pita and Jon don tel dia stori and prish God wod finish, dem kon go bak to Jerusalem, dey prish God wod for insaid Samaria, as dem dey go.

26 God angel kon tel Filip, "Get up mak yu waka for di desert road wey dem dey pas from Jerusalem go Gaza."

27 So Filip kon dey waka dey go wer di angel tel am. As e dey go, e mit won unok wey kom from Ethiopia, e bi ofisa for Kandace, Ethiopia queen and na-im dey kip dia moni. E kon woship God for Jerusalem

28 and e dey go haus bak. E sidan for en horse dey read di book wey Profet Isaia rite.

29 Naim di Holi Spirit tel Filip, "Mak yu waka go mit di man."

30 So Filip run go mit am kon hear am dey read wetin Profet Isaia rite. So e kon ask di man, "Yu undastand wetin yu dey read so."

31 Di man ansa, "Haw I won tak undastand, unles pesin tish mi!" E kon tel Filip sey mak e kom sidan wit am.

32 Na di place wey e dey read for God wod bi dis, "Dem lid am laik ship go kil and as ship pikin dey kwayet wen dem dey shave-am, na so tu e nor opun en mout.

33 "Dem disgrace am kon tak pawa from en hand. Nobodi go fit tok abaut en shildren or en gran shildren, bikos dem kil-am wen e stil dey young."

34 So di man ask Filip, "Abeg tel mi, na hu dis profet dey tok abaut? Na ensef, abi na anoda pesin?"

35 Filip kon start to prish di Gud News abaut Jisos Kraist giv di man from di place wey e dey read.

36 As dem dey go, dem kon rish wer wota dey, naim di man sey, "Si, wota dey here! Wetin go mak mi nor baptaiz naw?"

37 Filip ansa, "If yu biliv, I go baptaiz yu." Di man kon sey, "I biliv sey Jisos Kraist na God Pikin."

38 So e tel di driva mak e stop, Filip wit am waka go wer di wota dey and e kon baptaiz am.

39 Wen dem kom out from di wota, God Spirit kari Filip komot from der and di man nor si-am again, bot e kon dey hapi as e dey go.

40 Filip si ensef for Azotus and as e dey waka pas for di aria, e kon dey prish di Gud News for all di tawns til e rish Sizeria.

Open Bible reader