Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 4

1 As Pita and Jon stil dey tok, di prists, di Tempol gaid oga and di Sadusi pipol waka kon mit dem.

2 Dem dey ves, bikos Pita and Jon dey tish di pipol sey, na onli tru Jisos Kraist, pipol go fit wak-up from deat.

3 So dem arres dem put for prizin til di next day, bikos nite don rish.

4 Bot pipol wey hear wetin dem tok kon biliv Jisos Kraist and di pipol wey biliv, rish faiv tazon.

5 Di next day, all di rulas, eldas and lawyas kon gada go Jerusalem.

6 Annas, wey bi di High Prist dey der wit Kaifas, Jon, Alexanda and som membas for di High Prist famili.

7 Dem drag Pita and Jon enta dia senta kon bigin ask dem, "Hu giv una pawa to du dis tins? Na wish pesin name una dey yuz so?"

8 Pita wey di Holi Spirit dey yuz wel-wel kon ansa, "Awa rulas and eldas,

9 na bikos of di gud wey wi du for dis pesin wey nor wel, naim mak una dey kweshon us today sey, 'Haw dis man tak wel?'

10 "My pipol and di oga dem for Izrel, mak una no sey, Jisos Kraist wey kom from Nazaret, di pesin wey una kil and God raiz-am from deat, naim name mak dis man wey una dey si so, wel.

11 "Dis Jisos Kraist, di gud stone wey una trowey, God don mak am di main pila wey dey hol di haus.

12 "And na en pawa God dey yuz save pipol, bikos for di hol wold, e nor get eni oda name wey get pawa to save pipol, laik Jisos Kraist own."

13 Di oga dem sopraiz wen dem si haw Pita and Jon tak tok ivun doh dem nor go school. So dem kon no sey dis na di pipol wey don folo Jisos Kraist waka.

14 And as dem si sey di man wey God heal stand der wit Pita and Jon, dem nor fit denai wetin hapun.

15 So dem sey mak Pita and Jon komot for wer dem dey, den dem bigin ask ish oda,

16 "Wetin wi go du abaut dis pipol? Bikos evribodi wey dey for Jerusalem don no sey na big mirakol naim God yuz dem du so and wi nor go fit denai am.

17 "Bot mak di mata nor for kontinu dey spread among di pipol, mak wi warn dem mak dem nor tok abaut dis name again."

18 So dem kol dem go insaid kon tel dem mak dem nor tok or tish abaut Jisos Kraist name again.

19 Bot Pita and Jon ansa, "Mak una joj wetin gud pas for dis mata; mak wi obey una or mak wi obey God,

20 bikos wi nor go fit sey mak wi nor tok abaut wetin wi don si and hear."

21 Afta dem warn Pita and Jon wel-wel, di Ju pipol kon liv dem mak dem dey go, as dem nor fit ponish dem for di pipol front, bikos dem gada dey praiz God for wetin hapun so.

22 Di man wey risiv dis big mirakol, don pas forti years.

23 As dem fri dem, Pita and Jon go mit dia pipol kon tel dem evritin wey di High Prist and di eldas tok.

24 Wen dem hear wetin hapun, dem kon pray to God sey, "God wey dey for hevun, Yu wey mak hevun, eart, di sea and evritin wey dey insaid dem.

25 "Yor Spirit tok tru yor savant David, awa gran-gran papa dem sey, 'Wetin dey mak pipol wey dey woship juju dey mak nois? Wetin mak dem dey plan bad-bad tins?

26 "All di kings wey dey di wold stand and di rulas gada togeda against Jehova and di pesin wey E shuz.

27 "Tru-tru, Herod, Pontius Pilate, Izrel pipol and doz wey nor bi Ju kon gada for di tawn against Jisos Kraist, yor holi savant wey Yu shuz

28 and dem dey doh wetin yu don alredi plan sey go hapun.

29 "Papa God, mak Yu si haw dem dey treaten us. Wi wey bi yor savants, mak Yu giv us pawa to tak prish yor wod,

30 enitaim wen wi kol Yor holi pikin Jisos Kraist name, mak Yu heal pipol and du meni wondaful mirakols."

31 Wen dem pray finish, di place wey dem gada put kon dey shake. Di Holi Spirit enta all of dem and dem kon dey prish God Wod wit pawa.

32 All di pipol wey biliv Jisos Kraist kon dey du tins togeda wit won maind and nobodi sey e go yuz wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propati togeda.

33 Wit God pawa, di apostols kon dey bear witnes sey Jisos Kraist wak-up from deat and God favor kon dey show for dia life wel-wel.

34 Nobodi among dem sofa, bikos di rish pipol among dem wey get land and haus, dey sel dia propati and bring di moni wey dem sel

35 kon giv di apostols mak dem kip am, so dat dem go gi-am to enibodi to tak buy wetin e wont.

36 So Josef wey kom from Levi tribe and wey di apostols dey kol Banabas (wey min pesin wey dey enkorage pipol) and en hometawn na Syprus,

37 sel won land wey e get kon giv di moni to di apostol mak evribodi yuz.

Open Bible reader