Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 23

1 Pol luk di kansol pipol kon tel dem, "My brodas, I dey liv my life wit klin maind for God eye kon rish today."

2 Bikos of wetin e tok, Ananias wey bi di High Prist kon orda di pipol wey stand near Pol sey mak dem slap am for mout.

3 So Pol tel am, "God go slap yu tu, yu wey dey pritend! Yu sidan dey joj mi wit di law, yu nor dey disobey di law wen yu sey mak dem slap mi?"

4 Di pipol wey stand near am kon sey, "Yu dey kos God High Prist?"

5 Pol ansa, "I nor no bifor sey naim bi di High Prist, bikos God wod sey, 'Mak yu nor tok bad abaut di pesin wey dey rule yor pipol.'"

6 Den wen Pol no sey som pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisis, e kon shaut mak di hol kansol hear, "My brodas, I bi Farisi, na Farisi pesin born mi. Dem dey joj mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wak again!"

7 Wen e tok dis tin, kworel kon start bitwin di Farisi and di Sadusi pipol and di kansol kon divide.

8 (Bikos Sadusi pipol biliv sey pipol wey don die, nor go wak again and dem nor biliv sey enitin laik angel or spirit dey sef, bot Farisi pipol biliv all dis tins.)

9 So kworel kon start bitwin dem and som oga for law mata wey bi Farisi pipol kon stand-up dey opoz di Sadusi pipol sey, "Wi nor si enitin bad wey dis man du. Una no weda na spirit or angel tok to am?"

10 Wen di arguement kon tu mush and di komandin ofisa dey fear sey dem go tear Pol to pisis, e kon orda en sojas mak dem enta di mitin and kari Pol komot for der by fos.

11 For nite for di next day, Jisos kon stand near Pol tel am for vishon, "Mak yu nor fear, bikos as yu don testifi abaut mi for Jerusalem, na so yu go stil du for Rome."

12 Wen mornin rish, som Ju pipol kon gada dey mak bad plan and dem swear sey dem nor go chop or drink enitin ontil dem kil Pol.

13 Di pipol wey mak dis bad plan pas forti.

14 Dem go mit di prist oga dem and di eldas tel dem sey, "Wi don swear sey wi nor go chop enitin ontil wi kil Pol.

15 So mak una and di kansol tel di komandin ofisa mak e bring Pol kom mit una, laik sey una won joj en kase again. Wi redi to kil-am, bifor e go rish dis place."

16 Bot wen Pol sista pikin hear abaut dis plan, e run go insaid di barrak go tel Pol.

17 Pol kon kol won soja oga tel am, "Tak dis boy go mit di komandin ofisa, bikos e get somtin wey e won tel am."

18 So di soja oga tak di boy go mit di komandin ofisa kon sey, "Pol, wey dey prizin, sey mak I bring dis boy kon mit yu, bikos e get somtin wey e won tel yu."

19 Di komandin ofisa hol di boy for hand go won kona kon ask am, "Wetin yu won tel mi?"

20 Di boy ansa, "Ju pipol dey plan sey dem go ask yu mak yu bring Pol kom di kansol tumoro, laik sey dem won ask am kweshon again.

21 "So mak yu nor alow dem disiv yu, bikos dem pas forti wey hide for bush won kil-am. Dem don swear sey dem nor go chop or drink enitin, ontil dem don kil Pol. Naw, dem dey wait for yu to gri for wetin dem won ask yu."

22 So di komandin ofisa tel di boy mak e dey go kon warn am sey, "Nor tel enibodi sey yu don ripot dis mata giv mi."

23 Den e kol tu soja oga kon tel dem, "For nain o' klok dis nite, mak una redi tu ondred sojas wey go-go Sizeria, plus sevunti, wey go ride horse and tu ondred, wey go kari spear.

24 "Mak una arange horse wey Pol go sidan put, so dat una go fit gaid am wel-wel go mit Felix wey bi di govnor.

25 E rite leta laik dis:

26 "From Klaudios Lysias to Govnor Felix, I salot yu!

27 "Di Ju pipol seize dis man and dem nearli kil-am bifor I rish der wit my sojas. Wi kon save am from dia hand, bikos I faind out sey, e bi Roman citizin.

28 "Bikos I won no di offence wey e komit, I kon kari am go dia kansol.

29 "I kon si sey en offence, na abaut wetin dem dey argue abaut for dia law, bot e nor du enitin wey rish to kil-am or put am for prizin.

30 "Wen won pesin tel mi sey dem dey plan to kil-am, naim I send am kon mit yu at wons and I stil orda di pipol wey dey akuiz am mak dem kom tok wetin e du for yor front."

31 So di sojas kari Pol for nite ontil dem rish Antipatris, jos as dia oga komand dem.

32 Di next day, di tu soja oga liv di men wey dey ride horse folo Pol and dem kon go dia barrak bak.

33 Wen di men wey dey ride horse rish Sizeria, dem kon tak Pol and di leta giv di govnor.

34 Wen di govnor don read di leta, e ask dem wer Pol from kom. Wen e hear sey e kom from Silicia,

35 e kon sey, "I go hear yor kase wen di pipol wey akuiz yu rish here." Den e orda sey mak dem gaid Pol for insaid Herod palise.

Open Bible reader