Nigerian Pidgin Bible
Acts 2
1 Wen Pentecost Day rish, di disaipols kon gada for won place.
2 At wons, won kaind nois wey bi laik heavi briz kom from hevun kon ful di hol haus wer dem sidan.
3 Dem kon si smol-smol fire wey bi laik kando lite dey fal kom from hevun on-top dia head, won-by-won.
4 Den di Holi Spirit enta dia bodi and as di Spirit giv dem pawa, dem kon start to tok for difren language.
5 Dat taim, Ju and oda pipol dey stay for Jerusalem.
6 Wen pipol hear di nois, dem sopraiz kon gada, bikos evribodi dey hear di disaipols dey tok wit difren language, wey demsef dey tok for dia kontri.
7 As di pipol dey sopraiz, dem kon dey ask ish oda, "All dis pipol wey dey tok so, nor bi Galili dem from kom?
8 "Haw e bi sey dem dey speak awa difren language?
9 "Wi wey kom from Partia, Medes, Elam, Mesopotamia, Judea, Kapadosia Pontus and all di aria wey dey for Asia,
10 Frigia and Pamfilia, ivun di pipol from Egypt and di aria for Libya near Syrene, plus all di strenjas wey kom from Rome,
11 weda dem bi Ju or Gentai, wey dey serv God wit dem, laik pipol from Krete and Arabia, all of us dey hear, as dem dey yuz awa language praiz God!"
12 All of dem sopraiz and di tin konfuz dem wel-wel. So dem kon dey ask ish oda wetin dis kaind tin min.
13 Bot som of dem dey laff di pipol wey dey speak di difren language kon dey sey, "Dis pipol don drink wel-wel!"
14 Bot Pita stand-up wit di ilevun apostols kon shaut: "Judea pipol and una wey dey Jerusalem, mak una put ear dan for wetin I won tel una so. Mak una no sey
15 dis men neva drink enitin as una tink, bikos na jos nain o' klok for mornin and e tu earli to drink.
16 "Bot na as Profet Joel tok sey:
17 'Wen di last day don rish, God sey, "I go pour my Spirit insaid evribodi and all una shildren, both boys and girls go dey profesai, una young men go dey si vishon and una old men go dey dream plenti dreams.
18 "For dat taim, I go giv my Spirit to all di pipol wey dey serv mi and dem go dey profesai.
19 "I go show plenti wondas for hevun and meni mirakols for dis wold, blood and fire go apier for insaid di skai laik smoke.
20 "Di sun go blak and di moon go red laik blood, bifor di big day wen God tok abaut, go rish.
21 "For dat taim, evribodi wey kol God name, God go save am.'"
22 "Izrel pipol, mak una hear wetin I dey tok, Jisos Kraist wey kom from Nazaret, di man wey God shuz and wey e send to una, wey God yuz du meni mirakols and oda wondaful signs for una front, as all of una no,
23 na Judas sel dis man giv Ju pipol, bikos na so God plan am from biginin. Una no sey una kil-am, wen una gi-am to di sojas mak dem nail am for kros.
24 "Bot God kon raiz-am up afta E don giv am pawa to konka deat, bikos deat nor get pawa to hol am.
25 "Dis na wetin David tok abaut sey, 'God always dey near mi and bikos e dey for my rite hand, I nor go fear enitin.'
26 "Bikos of dis, bele swit mi and my mout kon dey tok beta-beta tins and I kon get hope sey tins go rili gud for mi,
27 bikos I no sey God nor go alow mi stay for grave or mak my bodi rotin for groun.
28 "Tru-tru, Yu don show mi di way wey dey giv life and Yu go mak mi hapi wel-wel wen I dey for wer Yu dey."
29 My pipol, "Nor bi tru sey awa gran-gran papa David don die since, dem bere am and en grave dey awa land til today?
30 "Wi no sey en na profet, bikos God don promis am sey, naim pikin dem go always bi king for Izrel.
31 "Bikos of dis vishon wey David si, e kon sey, 'Di Mezaya go get up from grave, bikos God nor go liv am der mak en bodi rotin for groun.' As all of us no,
32 God don raiz dis Jisos Kraist up and evribodi si-am.
33 "Bikos God don promote am mak e dey en rite hand and e don risiv di Holi Spirit wey en Papa promis, e kon pour di Holi Spirit for awa bodi, as una si-am dey hapun so.
34 "Wi no sey David neva go hevun, bot onli en tok wit en mout sey, 'God tel Jisos Kraist sey, "Sidan for my rite hand,
35 ontil I go mak all yor enemis serv yu."'
36 "So Izrel pipol, mak una no sey, God don turn dis Jisos Kraist wey una kil, to bi Oga and Mezaya."
37 Wen di pipol hear dis prishin, e trobol dem for maind wel-wel and dem kon ask Pita and di res apostols, "Awa brodas, wetin wi go du naw?"
38 Pita ansa dem, "Mak una turn from sin kom mit God won-by-won and mak dem baptaiz una wit Jisos Kraist name, so dat God go forgiv una, den una go fit risiv di Holi Spirit.
39 "Bikos dis promis na for una, all una pikin, pipol wey dey far place and all di pipol wey God go draw near ensef."
40 As Pita dey tok to di pipol, e kon warn dem, "Mak una save una head from di ponishment wey dey kom mit wiked pipol."
41 So, dem baptaiz all of dem wey biliv wetin e prish and dem rish tiri tazon pipol wey join dem dat day.
42 Dem kon dey yuz all dia taim dey learn wetin di apostols dey tish. Dem dey waka, help, chop and pray togeda.
43 Di apostols du meni wondas and mirakols and bikos of dis, pipol kon dey respet and fear God.
44 All di pipol wey biliv, dey share dia propati wit won anoda and stay togeda.
45 Dem dey sel wetin dem get kon yuz di moni dey help ish oda.
46 Dem dey stay togeda evriday laik won big famili. Dem dey gada go di Tempol togeda and dem dey go from haus to haus, dey chop togeda wit hapines.
47 Dem kon dey praiz God and dey feloship wit won anoda. So God kon dey add more pipol join dem evriday.