Nigerian Pidgin Bible
Acts 15
1 Som men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, "Unles dem sekonsaiz una di way Mosis tok for di law, una nor go fit get salvashon."
2 Wen Pol and Banabas don argue wit di pipol wel-wel, di shosh pipol kon send Pol and Banabas wit som oda pipol go Jerusalem go mit di apostols and di eldas, so dat dem go ask dem abaut di mata.
3 So di shosh send dem go and as dem dey go, dem pas Fonicia and Samaria kon tel pipol wey dem mit for der haw Gentai pipol tak turn from dia sin kom mit God and di stori mak all di brodas wey hear am, hapi wel-wel.
4 Wen dem rish Jerusalem, di hol shosh wit di apostols and di eldas kon welkom dem, den dem tel dem evritin wey God don yuz dem du.
5 Bot som Farisi wey don biliv Kraist stand-up kon sey, "E gud mak wi tel Gentai pipol mak dem sekonsaiz and du evritin wey Mosis law tok."
6 Di apostols and di eldas kon hol mitin to tok abaut di mata.
7 Afta dem don argue wel-wel abaut di mata, Pita kon stand-up sey, "My brodas, una no sey bifor-bifor, na mi God shuz mak e go prish giv Gentai pipol mak dem hear and biliv en wod.
8 "And God, wey no wetin dey insaid pipol maind, don show ensef to dem wen E giv dem di Holi Spirit, jos as E giv us
9 and E nor du wayo bitwin wi and dem bikos, E mak dia heart klin by fate.
10 "So why una won kon trai God? Load wey wi and awa gran-gran papa dem nor fit kari, why una dey put am for dis disaipols head?
11 "Wi biliv sey God save us tru grace wey kom from Jisos Kraist, jos as E du for dis Gentai pipol tu."
12 Evribodi wey dey for der kon kwayet dey hear wetin Banabas and Pol dey tok and dem tel dem abaut di mirakols and wondas wey God yuz dem du among Gentai pipol.
13 Afta dem don tok finish, James ansa, "Awa brodas, mak una hear wetin I won tok.
14 "Simeon don tel us haw God first shuz som pipol from Gentai wey go dey tok abaut am.
15 "Dis tins gri wit wetin di profets tok bifor sey:
16 'Afta all dis tins, I go kom bak and I go build David haus wey don fal; I go build am wit all di sand wey skata for groun and e go strong again,
17 so evribodi go kom mit God, plus Gentai pipol wey I don kol to bi my pipol.' God wey mak all dis tins, na so E tok
18 and E no sey na so e go bi.'
19 "So, I go sey mak wi nor mak tins hard for Gentai pipol wey jos start to serv God,
20 bot insted, mak wi rite leta go giv dem sey, mak dem nor chop fud wey dem sakrifias giv juju and mak dem nor slip wit hu dem nor mari, anima wey dem kil and di blood nor tosh groun, mak dem nor chop or drink en blood.
21 "Bikos na since awa gran-gran papa dem taim dem don dey prish Mosis law for di sinagog for evri Sabat Day."
22 So di apostols, eldas and di hol shosh kon gri sey dem go send som men folo Pol and Banabas go Antiok. Den shuz Judas, wey dem dey kol Basabas and Silas and dem bi ledas among di brodas.
23 Na wetin dem rite for di leta, bi dis, "From di apostols and eldas wey bi una brodas, to all di brodas and sistas wey bi Gentai wey dey Antiok, Syria and Silicia. Wi grit una o-o!
24 "Wi hear sey som pipol kom mit una sey dem kom from us, ivun doh wi nor send dem. Dem dey konfuz and tel una wetin go disturb una maind.
25 "So all of us kon gri sey mak wi shuz pipol wey go folo Banabas and Pol, wey bi awa frend, kom mit una.
26 "Dis men dey risk dia life, bikos of awa Oga Jisos Kraist name.
27 "So wi send Judas and Silas wey go tel una all this tins by demsef.
28 "Bikos wi and di Holi Spirit nor won put heavi load for una head, so na dis smol advise wi dey giv una:
29 'Wi advise sey mak una forbid meat and blood wey dem don sakrifias giv juju and eni anima wey una kil wey en blood nor tosh groun. And mak una nor slip wit hu una nor mari.' If una forbid all dis tins, una go du wel!"
30 So wen dem don send dem go, dem kon go Antiok and afta dem gada evribodi, dem kon giv dem di leta.
31 Bikos of wetin dem rite put for di leta, all di pipol hapi wen dem read am out.
32 Bot Judas and Silas, wey bi profet, enkorage di pipol and wetin dem tok kon mak di pipol heart strong.
33 Afta dem don stay der tey smol, di brodas kon send dem bak wit peace to di pipol wey send dem kom.
34 Bot Silas sey e go stil stay der for somtaim.
35 Pol, Banabas and odas kon stil stay for Antiok dey tish and prish God wod.
36 Afta som days, Pol kon tel Banabas, "Mak wi go bak go visit di brodas for all di tawn wey wi for prish God wod, so dat wi go no haw dem dey."
37 Banabas won kon kari Jon Mark folo bodi,
38 bot Pol sey mak dem nor kari am, bikos na so e tak liv dem for Pamfilia bifor and e nor folo dem du di wok.
39 Dis mata kon kause serious kworel, sotey dem kon seprate. Banabas tak Mark folo bodi and dem kon enta ship go Syprus,
40 bot Pol shuz Silas and dem go mit di brodas and sistas kon pray mak God bless dem.
41 Pol pas tru Syria and Silicia dey enkorage di pipol wey dey di shosh dem for der.