Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Acts 12

1 For dat taim, King Herod kash som pipol wey dey go shosh kon sey e go kil dem.

2 E kil James, wey bi Jon broda, wit sword.

3 Wen e si sey di Ju pipol hapi wit wetin e du, e kon arres Pita tu. (Dis tin hapun for di taim wey dem dey du di bread wey nor get yist fist.)

4 Wen e don kash Pita put for prizin, e put for sojas for for difren grups, mak dem gaid am. Herod plan na to bring Pita out mak e joj am for di hol tawn front wen Passova don finish.

5 So as Pita dey prizin, di pipol wey dey di shosh dey pray to God for am, day and nite.

6 Bot for di nite bifor dem go joj am, dem tie Pita wit tu chains and e slip for tu sojas senta. Oda sojas stil dey di prizin front, dey gaid am.

7 God angel apier and lite kon shine for di prizin. Di angel wak Pita kon tel am, "Get up kwik-kwik!" At wons, di chains fal komot from Pita hand.

8 Di angel sey, "Wear yor klot and yor sandal." So Pita du wetin di angel tel am. Den di angel sey, "Wear yor koat mak yu folo mi."

9 Pita folo am go outsaid. E biliv sey wetin dey hapun so na tru, e tink sey na dream e dey dream.

10 Afta, en and di angel kon pas di first and di sekon sojas grup, den dem kon rish di iron gate wey go di tawn. Di gate opun by ensef and dem go outsaid kon waka pas won smol strit, den di angel kon liv am for der.

11 Wen Pita si sey all dis tins wey dey hapun, nor bi dream, e kon sey, "Naw I no sey, 'Tru-tru, God send en angel kon save mi from Herod hand and from all di tins wey di Ju pipol tink sey go hapun."

12 Wen Pita eye don klear, e kon waka face Mary haus wey bi Jon Mark mama, wer meni pipol gada dey pray for am.

13 Wen e nok di door, Rhoda, won savant girl, kon ansa.

14 Wen di girl hear Pita vois, e kon dey hapi sotey e nor rimemba to opun di door, bot e run go tel dem sey Pita dey for outsaid.

15 Dem ansa di girl, "Yu nor no wetin yu dey tok!" Bot di girl stil dey sey na Pita, so dem kon sey, "E go bi en spirit!"

16 Bot Pita stil dey nok and wen dem opun di door si-am, dem kon sopraiz.

17 E yuz en hand tak tel dem mak dem kwayet and e kon tel dem haw God tak fri am from prizin. E tel dem, "Mak una tel James and all di brodas dis stori," den e liv dem kon go anoda place.

18 Wen day break, di sojas wey dey gaid Pita sopraiz wel-wel and fear kash dem wen dem nor si-am again.

19 Wen Herod send pipol go faind am and dem nor si-am, e kweshon di sojas wey dey gaid Pita kon komand sey mak dem kil all of dem. Den Herod komot from Judea go Sizeria go stay.

20 Herod kon dey ves wel-wel for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si-am. Bot dem kon first beg Blastus wey bi di king ofisa, mak e help dem beg am, bikos na di king kontri dey suppli fud giv dia kontri.

21 Wen di day wey dem gri to mit am don rish, Herod kon wear en king dress and e kon sidan for en throne dey folo dem tok.

22 Bot as e dey tok, di pipol wey gada kon dey shaut, "Na god dey tok so-o, nor bi man!"

23 At wons God angel kon nak Herod fal for groun, bikos e nor giv God glori and plenti worm kon chop en bodi til e die.

24 Bot God wod kontinu to dey spread.

25 Banabas and Sol kon go bak to Jerusalem wen dem don finish dia wok and dem tak Jon Mark folo bodi.

Open Bible reader