Nigerian Pidgin Bible
Acts 11
1 Di apostols and di brodas wey dey Judea kon hear sey Gentai pipol tu don risiv God wod.
2 So wen Pita rish Jerusalem, di bilivas wey bi Ju kon bigin argue wit am sey,
3 "Yu go chop wit pipol wey dem nor sekonsaiz."
4 Bot Pita tel dem evritin wey hapun. E kon sey,
5 "As I dey pray for Jopa I kon si vishon. For insaid di vishon, I si somtin wey bi laik tray dey kom dan smol-smol from hevun, dem hol am for for kona and e kon stop for my front.
6 "As I luk insaid, I kon si animas wey get for leg, bush meat, di wons wey dey krip and difren-difren birds.
7 "I stil hear won vois wey tel mi sey, 'Get up Pita, kil som, mak yu chop.'
8 "Bot I ansa, 'Oga, I nor fit, bikos since dem born mi, I neva chop enitin wey nor dey klin.'
9 "Bot di vois from hevun kon tel mi again, 'Wetin God don mak klin, mak yu nor forbid am!'
10 "Dis tin hapun tiri taims, den di tray kon go hevun bak.
11 "Na dat same taim tiri men wey dem send kom mit mi from Sizeria kon rish di haus wer wi dey stay.
12 "Di Holi Spirit kon tel mi sey mak I folo dem go. Sis brodas for Jopa folo mi go tu and wi kon enta di man haus.
13 "Di man tel us haw e si angel wey stand for en haus kon tel am, 'Send pipol go Jopa go kol Saimon wey dem dey kol Pita.
14 'Wen e kom, e go giv yu di mesage wey God go yuz tak save yu and yor famili.'
15 "And wen I start to tok, di Holi Spirit kon enta dem, jos as e enta us for di first taim.
16 "So I kon rimemba wetin di Oga don yuz en own mout tel us bifor sey, 'Jon yuz wota baptaiz pipol, bot God go baptaiz una wit di Holi Spirit.'
17 "So my pipol, if God fit giv doz Gentai pipol di same gift wey E giv us afta wi biliv Jisos Kraist, hu I bi to stop God?"
18 Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue wit am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, "Naim bi sey God don giv Gentai pipol di shanse to tak turn from sin kom mit am, so dat dem go get di life wey nor dey end."
19 All di pipol wey skata komot from Jerusalem di taim wey dem kil Steven kon travol go far place laik Fonicia, Syprus and Antiok, dey prish giv onli Ju pipol.
20 Bot som of dem wey kom from Syprus and Syrene kon go Antiok dey tok to di Greek pipol abaut di Gud News wey konsan Jisos Kraist.
21 God pawa dey wit dem and meni pipol wey biliv kon bigin dey folo Jisos Kraist.
22 Wen di pipol for di shosh wey dey Jerusalem hear di news, dem kon send Banabas go Antiok.
23 Wen e rish der kon si haw God don bless di pipol, e hapi wel-wel kon enkorage dem sey mak dem kontinu to woship God wit all dia heart.
24 Banabas na beta pesin, di Holi Spirit dey insaid am and e get fate wel-wel, so meni pipol kon bigin folo Jisos Kraist.
25 Banabas komot from der go faind Sol for Tarsus26and wen e si-am, e kon tak am go Antiok. Banabas and Sol stay der for one year dey tish di pipol wey dey di shosh and na for der dem for first kol di disaipols, "Kristens."
27 For di same taim, som profets kon go Jerusalem from Antiok.
28 Won of dem wey en name bi Agabush, get up and di Holi Spirit kon put wod for en mout sey, "Heavi hunga go hapun for di hol wold." Dis tin hapun di taim wen Klaudios dey rule.
29 So di disaipols, evribodi akodin to haw e fit du rish, kon sey dem go send moni go giv di brodas wey dey Judea.
30 Afta dem don kontribute, dem kon send Banabas and Sol go giv di eldas di moni wey dem gada.