Nigerian Pidgin Bible
Numbers 19:16
If you touch body of person wey die or wey dem kill, or if you touch human bone or grave, you go dey unclean for seven days. 17-18 Before you fit dey clean, someone wey dey clean go take some ashes of the cow wey dem burn and mix am with spring water inside pot. That same person go put hyssop branch inside the water and ashes, and sprinkle am on the Tent and everything wey dey inside am, with every person wey dey inside am. If you don touch human bone, grave, or dead body, make he sprinkle you the water.
Open Bible reader