Nigerian Pidgin Bible
Numbers 1:46
Dem begin dey count from Reuben tribe. Na Reuben be Jacob firstborn. Dem list names of mean wey don reach 20 years old and ones wey don pass, wey fit work for army. Dem list them according to their tribe and family. Na the total be these: Reuben tribe get 46,500 men; Simeon tribe get 59,300 men; Gad tribe get 45,650 men; Judah tribe get 74,600 men; Issachar tribe get 54,400 men; Zebulun tribe get 57,400 men; Ephraim tribe get 40,500 men; Manasseh tribe get 32,200 men; Benjamin tribe get 35,400 men; Dan tribe get 62,700 men; Asher tribe get 41,500 men; Naphtali tribe get 53,400 men. And the total number of men wey dem count na 603,550 in all.
Open Bible reader