Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Deuteronomy 17:12

E fit dey hard to find out truth for some legal cases for una town. Una fit no tell if person die accidentally or dem kill am. Or una fit no tell whether an injury or property wey destroy na by accident or person purposely do am. If the case dey too hard, make una take am to court for the place the LORD una God choose for una to dey worship him. Na one judge and plenty priests wey dey serve for God altar go dey inside this court. Dem go explain the law to una and give una their decision about the case. Make una do wetin dem ask una to do, or dem go kill una.

Open Bible reader