Nigerian Pidgin Bible
Titus 2
1 Bot for yu Titus, yu must tish pipol haw to bihav wel.
2 Mak yu tish old men sey, mak dem nor dey bihav enihaw, so dat pipol go respet dem and mak dem dey kontrol demsef; get fate; dey show luv and dey patient.
3 Mak yu tish old wimen sey, mak dem liv life wey go mak God hapi. Mak dem nor tok bad abaut pipol; nor dey drink enihaw, insted mak dem tish oda wimen wetin dey gud.
4 So, mak di old wimen train and tish di young wons haw dem go tak luv dia husban and shildren;
5 to dey knotrol diasef; get pure maind; dey du dia haus wok wel; dey kare for pipol; dey du as dia husban wont, so dat pipol nor go tok enihaw abaut God wod wey wi dey prish so.
6 Mak yu tish young men to dey liv dia life wit beta sense
7 and mak yu yorsef bi gud ezampol to dem. Mak evritin wey yu dey du, show sey wetin yu dey tish, na trut.
8 Mak yu prish di trut, so dat pipol nor go get rizin to tok against yu. Den doz wey dey opoz yu, go shame and dem nor go get wod to tok abaut us.
9 Una wey bi savant, mak una dey du evritin wey una oga wont and wen una oga tok to una, mak una nor dey ansa am enihaw.
10 Mak una nor dey tif, insted mak una dey show sey una get fate, so dat evritin wey una dey du, go bring praiz to God awa Savior.
11 Bikos God grace wey bring salvashon, don kom out mak evribodi si-am.
12 Di grace dey tish us sey, mak wi nor liv laik pipol wey nor no God or dey bihav enihaw. So mak wi dey kontrol awasef; dey du gud and folo God for dis taim wey wi dey so,
13 bikos wi dey wait for di day wen God sey Kraist, wey bi awa Almighti God and Savior, go kom.
14 E die for us, so dat e go fri and klin us from wikednes kon turn us to en own pipol wey laik to du gud tins.
15 Mak yu tish dem dis tins and koret dem wit boldnes. So, mak yu nor let enibodi trit yu laik smol pikin.