Nigerian Pidgin Bible
Titus 1
1 Na Pol, wey bi Jisos Kraist apostol and God savant rite dis leta to help pipol wey God don shuz, so dat dia fate go strong kon no di trut wey go help dem liv di kaind life wey God wont.
2 Di trut dey giv dem di maind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lai promis dem dis life ivun bifor E kreate di wold.
3 As di taim don rish, E don giv us en mesage tru di wod wey wi dey prish giv evribodi and na God awa Savior giv mi pawa to du dis wok.
4 I dey rite to Titus, my own pikin for fate. Mak grace and peace wey dey kom from God awa Papa and from awa Savior Jisos Kraist, dey wit yu.
5 Titus! Na dis mesage mak mi liv yu for Krete, so dat yu go kontinu awa wok for der and pick new lidas for ish tawn, jos as I komand yu.
6 Enibodi wey won bi elda must dey gud. E must get onli won wife and en shildren must bi bilivas, dey gentol and dey respet demsef.
7 Mak pesin wey bi lida nor get fault, bikos na God wok e dey du. Mak e nor dey kari bodi up; dey kwik ves or drink enihaw; dey laik to beat pipol or luv moni.
8 Insted mak e dey welkom stranjas for en haus; luv wetin dey gud and e must get sense; mak e nor dey put hand for bad tin; e must dey holi and fit kontrol ensef.
9 E must biliv di mesage abaut God wey e dey tish, so dat e go fit tel pipol di trut and koret doz wey dey opoz am.
10 Meni pipol nor won du wetin God tok, insted, dem dey tok enihaw, dey disiv pipol and folo Ju pipol law wey sey, evribodi must sekonsaiz.
11 So wi must stop dem, bikos dem dey tish pipol tins wey go mak pipol komot from di trut and dem dey du laik dis, bikos of di moni wey dem go get.
12 Ivun won of dia own profets sey, "Krete pipol dey always tok lai, dem bi wiked animas and lazi pipol wey get long-trot."
13 Wetin di profet tok, na tru. So bikos of dis, mak yu stop dem, so dat di bilivas go strong for fate.
14 Mak dem stop to listin to Ju pipol lai-lai stori and nor dey bihav laik doz wey nor biliv.
15 Evritin dey pure to doz wey dia heart dey pure. Bot nor-tin dey pure to doz wey bad tins ful dia maind.
16 Dis kaind pipol dey sey dem no God, bot di way wey dem dey liv dia life, show sey dem nor no am, bikos dem get bad maind, dey disobey God and dem nor eva dey laik beta tin.~