Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Romans 15

1 If awa fate dey strong, den mak wi dey patient wit doz wey get wik fate. Mak wi trai to mak dem hapi, insted of awasef.

2 Mak wi tink of tins wey gud for dem, den du wetin go mak dem grow.

3 Ivun Kraist nor du tins wey go jos mak ensef hapi, bot jos as dem rite for God wod, "Di pesin wey kos yu, don kos mi."

4 Bikos evritin wey dem rite from biginin, na to tish, enkorage and giv us hope.

5 So, I pray sey, God wey dey giv komfort and patient, go help una liv for peace wit won anoda as una dey folo Jisos Kraist.

6 So dat as una dey togeda, una go fit yuz won vois praiz God, wey bi awa Oga Jisos Kraist, Papa.

7 So mak una asept won anoda jos as Kraist asept una, so dat God go get all di glori.

8 Mak I tel una di trut, Kraist kom as Ju pipol savant to show sey, God don kip di promis wey E mak wit dia gran-gran papa dem. Kraist stil kom,

9 so dat Gentai pipol go praiz God sey e dey gud to dem. Jos as God wod sey, "I go tel Gentai pipol abaut Yu and I go sing, dey praiz yor name."

10 God wod stil sey, "Gentai pipol! Mak una hapi wit God pipol."

11 Dem rite am for God wod sey, "Una wey bi Gentai pipol, mak una praiz God. Mak evribodi praiz am."

12 Profet Isaia sey, "Sombodi dey kom from David famili (Jesse root). E go rule Gentai pipol and dem go biliv am."

13 I pray mak God wey dey giv hope, bless una wit joy and peace bikos of una fate. So mak di Holi Spirit pawa ful una bodi wit fate.

14 My frends, I dey sure abaut una sey una gud and una no God wel-wel and fit tish won anoda.

15 Bot for dis leta, I rite som tins wit boldnes, so dat una go rimemba dem we-wel. God dey gud to mi and16naim mak am shuz mi to bi Jisos Kraist savant for Gentai pipol and mak I for dey prish di Gud News. Dis tin hapun, so dat di Holi Spirit go mak God dey hapi wit Gentai pipol.

17 So I dey boast abaut di tins wey I dey du, bikos of Jisos Kraist.

18 Wit beta maind, evritin wey I dey tok abaut, na haw Kraist let mi tok and wok, so dat Gentai pipol go obey am.

19 Yes! I go tok haw Kraist tak du meni mirakols and wondas tru di Holi Spirit pawa. I don prish di Gud News from Jerusalem go rish Ilyrikum.

20 Bot I laik to prish di Gud News for wer pipol nor no Kraist, so dat I nor go build haus on-top anoda man foundashon,

21 jos as God wod sey; "Doz wey dem tel abaut am, go si-am and doz wey neva hear abaut am, dem go undastand."

22 My wok neva let mi kom si una.

23 Bot naw, nor-tin rimain wey I go du for dis part of di wold again and e don tey wey I dey plan to kom visit una.

24 I go plan to stop si una wen I dey go Spain, so dat una go help mi for di joni, afta I don stay wit una for somtaim.

25 Bot naw, I dey tak mesage go giv God pipol for Jerusalem,

26 bikos God pipol for Masidonia and Akaya giv mi moni mak I giv di poor Kristains for der.

27 Dis na wetin dem rili won du. Bikos wen den share di tins wey dem get wit Ju pipol, naim bi sey dem don folo Ju pipol share dia spiritual blessins tu.

28 So, afta I don finish dis wok kon dey sure sey di bilivas don get dia blessins for Jerusalem, I go visit una wen I dey go Spain.

29 And I no sey wen I kom visit una, I go bring plenti blessins from Kraist kon giv una.

30 My brodas and sistas, I dey beg una wit Jisos Kraist and di Holi Spirit luv; mak una help mi pray to God.

31 Mak una pray mak God save mi from pipol wey nor biliv am for Judea and mak di bilivas wey dey Jerusalem, asept wetin I dey prish.

32 Mak una pray giv God, so dat I go kom visit una wit hapines.

33 So mak God wey dey giv peace, dey wit all of un a. Amen.

Open Bible reader