Nigerian Pidgin Bible
Romans 10
1 My brodas and sistas, I dey wish and pray to God from my heart evriday sey, mak God save dem wey kom from Izrel.
2 I no sey dem luv God, bot dem nor undastand am,
3 as e bi sey dem nor no haw God dey tak mak pipol gud, insted, dem dey trai to mak demsef gud by dia own pawa, since dem nor gri du wetin God wont.
4 Since Jisos Kraist kom, di law nor get pawa again and enibodi wey biliv God, go dey raitious.
5 Na dis raitiousnes wey di law tok, naim Mosis rite abaut sey: "Di pesin wey folo di law must du evritin wey di law tok."
6 Bot di raitiousnes wey fate dey giv pesin na sey: "Nor tok for yor maind sey, 'Hu go-go hevun go bring Jisos kraist kom dan?
7 or Hu go-go bring Kraist kom out from hell wer deat bodi dey?'"
8 Bot wetin e tok? "God wod dey near yu. Di wod wey wi dey prish near yu, e get fate and e dey yor mout and heart."
9 Bot if yu konfes wit yor mout sey, "Jisos Kraist na Oga and yu biliv for yor heart sey, God raiz-am from grave, yu go dey save."
10 If yu biliv and prish wit yor heart giv pipol sey Jisos Kraist na Oga, God go save yu.
11 Bikos God wod sey, "Enibodi wey biliv am, nor go shame."
12 Ju and Gentai pipol nor dey difren for God eye and E dey bless evribodi wey dey pray to am,
13 bikos E go save doz wey dey kol en name.
14 Haw dem won tak kol God mak E help dem, wen dem nor biliv am? And haw dem go fit biliv, wen dem neva hear abaut am? Haw dem go tak hear abaut am, if nobodi prish to dem?
15 Haw pesin go prish God wod wen God nor send am? As God wod sey, "Pipol wey dey prish di Gud News dey waka wel, bikos na gud tins dem dey bring!"
16 Bot nor bi evribodi gri asept di Gud News, ivun profet Isaia sey, "God, enibodi don biliv awa mesage?"
17 So, nobodi go fit get fate wen e neva hear di mesage and na tru Kraist wod, wi go fit hear am.
18 Bot mak I ask, dem neva hear di mesage bifor? Yes! Dem don hear am, bikos God wod sey, "Dem prish di mesage and dia vois rish evriwer for di wold."
19 I dey ask una again, "Izrel pipol nor undastand?" Mosis first tok sey, "I go yuz pipol wey nor bi enitin, so dat una go dey jelos dem. Na pipol wey nor get sense, na dem I go yuz tak mak una ves."
20 And profet Isaia ivun get strong heart to tel di pipol sey, "Pipol wey nor luk for mi, na dem si mi. Doz wey nor ask for mi, na dem kon no mi wel-wel."
21 Bot Profet Isaia stil tok abaut Izrel pipol sey, "I don dey kol dis my stuborn pipol, bot dem nor dey hear wod."