Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 40

1 I been dey wait patiently for help of God; he con listen to me and hear my cry.

2 He pull me commot from dangerous pit, out of situations wey dey deadly. He put me on top solid ground and he no allow my feet slide.

3 He put a new song for my mouth, song of praise to our God. Many go see wetin he don do and worship him. Dem go put their trust in the LORD.

4 Those wey trust in the LORD na happy people, those wey no dey turn to idols or join those wey they worship false gods.

5 You don do plenty things for us, O LORD our God; no one be like you! You don make wonderful plan for us. I no fit talk about all of them - the number plenty!

6 You no want sacrifice and offerings; you no dey ask for animal wey dem burn for altar or sacrifice to take away sin. Instead you don give me ear to dey hear,

7 so I been answer say, “I dey here; your instruction for me dey for the book of law.

8 I love to dey do your will, my God! I dey keep wetin you teach me in my heart.’’

9 God, for the place wey your people dey gather, I been talk about the good news say na you save us. You know say I no go stop to dey talk am.

10 I never hide the news of salvation to myself; I dey always talk of your faithfulness and help. For the place all your people dey gather, I never dey silent about your love and loyalty always.

11 LORD, I know say you no go ever stop to dey merciful to me. Your love and loyalty go always dey keep me safe.

12 Plenty trouble dey surround me - dem too plenty to dey count; My sin don catch me, and I no fit see again; dem plenty pass the hair wey dey my head, and I don lose my courage.

13 Save me, O LORD, make you help me now;

14 Make those wey wan kill me dey confused and defeated. Make those wey dey happy because of my trouble turn back with disgrace.

15 Make those wey dey make fun of me dey for shock by their defeat.

16 Make all people wey come to you dey glad and joyful. Make all people wey dey thank you for your salvation talk say, “the LORD na great God!”

17 I dey weak and poor, O LORD; but you never forget me. You be my savior and my God - hurry come help me!

Open Bible reader