Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 109

1 I praise you, God; no remain silent!

2 Wicked people and liars don attack me. Dem dey lie about me

3 and dem dey say evil things about me, dem dey attack me for no reason.

4 Dem dey oppose me even when I love them and I dey always pray for them.

5 Dem dey use evil pay me back for good and use hate pay me back for love.

6 Choose some judge wey corrupt and use them try my enemy, and let one of him own enemy accuse him.

7 Make dem find him guilty for court; make him prayer even be like crime!

8 Make him life end soon; make another person take him job!

9 Make him children turn orphan, and make him wife turn widow!

10 Make him children dey homeless and turn beggar; make dem drive them commot from the life wey don spoil wey dem dey live

11 Make the people wey him dey owe take all him property away, and make stranger collect everything wey him don work for.

12 Make nobody dey kind to him or care for the orphan wey him leave behind.

13 Make all him descendant die, and make dem forget him name for next generation.

14 Make God remember the evil of him ancestor and never forgive him mama sin,

15 Make God dey always remember their sin, but make nobody remember them again.

16 That man no dey think to dey kind; he dey suffer and kill the poor and people wey dey in need, and helpless.

17 He like to dey curse - make curse dey on top him! he hate to dey give blessing - make nobody bless am!

18 To dey curse na part of him daily life, just like the cloth he dey wear; him own curse go soak enter him body like water and enter him bone like oil!

19 Make dem cover him like cloth and always dey around him like belt!

20 LORD, make you punish my enemy like that - those wey dey talk evil thing against me!

21 But my LORD, help me as you don promise, and save me because your love dey good.

22 I dey poor and I dey in need; I don wound from the bottom of my heart.

23 I don almost disappear like evening shadow; I don dey blow away like insect.

24 My knee don weak because I no get food; I be like skin and bone.

25 When people see me dem dey laugh me; dem dey shake head for me.

26 Help me, O LORD my God; make you save me because of your love wey no dey change.

27 Make my enemy know say na you save me.

28 Dem fit curse me, but you go bless me. Make everyone we dey suffer me dey defeated, and me wey be your servant, make I dey happy.

29 Make shame catch my enemy; make dem wear their shame like cloth.

30 I go give loud thanksgiving to the LORD; I go praise him for where people dey gather,

31 because him dey defend the poor and save them from those wey dey suffer them to die.

Open Bible reader