Nigerian Pidgin Bible
Numbers 35
1-2 When people of Israel still camp for lowlands of Moab across Jordan River from Jericho, God tell Moses, Tell Israelites say, when una receive una tribe lands, make una give towns and pastures to Levi tribe.
3 So that Levites go get towns to dey live and pastures for their animals.
4-5 Make the pastures wey round the towns dey for shape of square, with the town for center. Make the pasture be 900 meters for each side, with 450 meters of land outside of the town walls. Na Levites pasture land e go be.
6 Six of the towns wey una give them go be Safe Towns where person wey kill someone by mistake fit run go for protection. But una go also give Levites 42 other towns,
7 so dem go get total of 48 towns with pasture wey surround them.
8 Since the towns for Levites must come from Israel tribe lands, the large tribes go give more towns pass the smaller ones.
9 God come tell Moses
10 make he tell people of Israel say: After una don cross Jordan River and settle for Canaan,
11 choose Safe Towns, where person wey kill someone by mistake fit run go for protection.
12 If the family of person wey die think say na murder, dem fit try take revenge. Anyone wey dem accuse of murder fit run go there for protection, make dem no kill am before dem do trial.
13 Na six the Safe Towns go be,
14 three for each side of Jordan River.
15 Dem go be place of protection for any person wey dey live for Israel and kill someone by mistake.
16-18 Suppose say una hit someone with a piece of iron or a large stone or a dangerous wooden tool, if that person die, then una don turn murderer and make dem kill una too
19 by one of the victim relatives. He go take revenge for him relative death when he find the person.
20-21 Or suppose say you dey vex and kill someone by pushing or hitting or by throwing something, you be murderer and make one of the victim family kill you too.
22-24 But if you no vex and kill someone by accident in any of those ways, make the town people hold a trial and decide if you dey guilty.
25 If dem decide say you no dey quilty, dem go protect you from the victim family and send you make you go stay for one of the Safe Town till the high priest die.
26 But if you leave the Safe Town,
27 and the victim family kill you, dem no fit punish him for killing you.
28 You must stay inside the town till the high priest die, by then you fit come back home.
29 Make Israel community dey always obey these laws.
30 Death na penalty for murder. But dem no fit kill person wey dem accuse of murder, unless at least two witness dey for the crime.
31 You no fit pay person money to escape death penalty, na with your own life you must pay!
32 And If dem decide say you no dey guilty of murder and you dey live for Safe Town, you no fit try to go back home; you must stay for there until high priest die.
33-34 I, the LORD, dey live among you people of Israel, so una land must dey pure. But when a murder happen, blood dey spoil the land, and e don become unclean. If e happen like that, make una kill the murderer, so that the land go dey clean again. Keep Murder out of Israel!