Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Numbers 26

1 After God don stop the terrible disease wey dey kill the Israelites, he tell Moses and Eleazar son of Aaron say,

2 “I want make una find out how many Israelites dey for each family. Then, una go make a list of every man wey don reach 20 years and older, wey fit serve for Israel army.”

3-4 Moses and Eleazar obey, and dem gather all men wey dey that group together. Dem gather for hills of Moab across River Jordan from Jericho. Na the Israelites wey come out of Egypt be this:

5-7 Na 43,730 men come from Reuben tribe, Jacob oldest son. Dem come from clans of Hanorch, Pallu, Hezdron, and Carmi.

8 Pallu na the father of Eliab

9 and grandfather of Nemuel, Dathan, and Abiram. Na the same Dathan and Abiram wey people choose, but dem follow Korah rebel against Moses, Aaron, and God.

10 That na when God make earth open up and swallow Dathan, Abiram, and Korah. After that same time, fire burn 250 men, make e be warning for other Israelites.

11 But he no destroy Kohahite clan.

12-14 Na 22,200 men come from Simeon tribe; dem come from clans of Nemuel, Jarmin, Jachin, Zerah, and Shaul.

15-18 Na 40,500 men come from Gad tribe; and dem come from clans of Zephon, Haggi, Shuni, Ozni, Eri, Arod, and Areli.

19-22 Na 76,500 men dey for tribe of Judah; dem come from clans of Shelah, Perez, Zerah, and Hezron and Hamul, wey Perez be their ancestor. Judah son Er and Onan don die for Canaan.

23-25 Na 63,300 men dey for Issachar tribe; dem come from clans of Tola, Pubaj, Jashub, and Shimron.

26-27 Na 60,500 men dey for Zebulun tribe; dem come from clans of Sered, Elon, and Jaleel.

28-34 Na 52,700 men dey for tribe of Manasseh, son of Joseph; dem be clan of Machir, clan of Gilead him son, and clan of him six grandsons: Lezer, Helek, Asriel, Shechem, Shemida, and Hepher. Zelophehad, son of Hepher no get son, but he get five daughters: Mahlah, Noah, Hoglah, Milcah, and Tirzah.

35-37 Na 32,500 men dey for tribe of Ephesians, son of Joseph; dem come from clans of Shuthelah, Beecher, Tahan, and Eran son of Shuthelah.

38-41 Na 45,600 men dey for Benjamin tribe; dem come from clans of Bela, Ashbel, Ahiram, Shephupham, Hupham, and from two sons of Bela, Ard and Naaman.

42-43 Na 64,400 men dey for tribe of Dan; dem come from clans of Shuham.

44-47 Na 53,400 men dey for Asher tribe; dem come from clans of Imnah, Ishvi, and Beriah, and from two clans of Heber and Malchiel, sons of Beriah. Na Serah be Asher daughter.

48-50 Na 45,400 men dey for Naphtali tribe; dem come from clans of Jahzeel, Guni, Jezer, and Shilem.

51 Na 601,730 be total number of Israelite men.

52 God tell Moses say,

53 “Divide Canaan land among these tribes, according to the number of people for each one,

54 so that large tribe go get land pass small tribe.

55-56 I go show you which kind land you go give each tribe, and dem go get enough land wey dem need, according to number of people dem get.

57 Na Levi tribe be clans of Gershon, Kohath, and Merari.

58 Their descendants na clans of Libni, Hebron, Mahli, Mushi, and Korah. Kohath na father of Amram,

59 wey marry Levi daughter, Jochebed, wey dem born for Egypt.

60 Aaron get four sons Nadab, Abihu, Eleazar, and Ithamar.

61 Nadab and Abihu die when dem offer unholy fire to God.

62 The male Levites wey be one month old or older nah 23,000 in number. Dem list them separate from the rest of Israelites, because dem no give them any property for Israel.

63 Na Moses and Eleazar count the Israelites when dem camp for hills of Moab across Jordan River from Jericho.

64 No man remain out of all the people wey Moses and Aaron count when dem dey Sinai Desert.

65 God don tell them say all of them go die for desert, but Caleb son of Jephunneh, and Joshua son of Nun, no go die.

Open Bible reader